Nnamdi Kanu court trial: Justice Binta Nyako order DSS to give di Ipob leader back im eyeglass before next court day

Nnamdi Kanu for court wit im lawyer
Wetin we call dis foto, Nnamdi Kanu for court on Tuesday, 16, February, 2022

Di Federal High Court for Abuja don fix April 8, 2022 to rule weda dem go throway di charges wey Nigerian goment sama ontop leader of di Indigenous People of Biafra, Ipob, Nnamdi Kanu head.

Justice Bintga Nyako, di trial judge tok wen di case of Kanu continue for court continue on Wednesday, 16, February, 2022.

Kanu dey face 15-count charge wey border on terrorism, treason, secession and dat im be member of Ipob group wey goment don outlaw.

E also dey face accuse say im broadcast lie about President Muhammadu Buhari, but Kanu bin don deny all di allegation say im no dey guilty.

But afta Kanu plead not guilty to di 15-count amended charges, di goment lawyer plus prosecutor, Shuiabu Labaran, bin ginger di trial judge, Binta Nyako, to order di trial to start.

Oga Labaran bin say dem don already bring witnesses come court and dem dey ready to begin trial immediately.

But Kanu lawyer, Mike Ozekhome, Senior Advocate of Nigeria (SAN), say im no go gree make trial just start sake of say dem get two pending applications wey dey challenge di charges against Kanu and court need to hear those application first before di trial go start.

E say dem want di court to discharge and acquit Kanu of all di charges wey goment sama on top im head sake of say no basis dey for di charge dem to stand.

Kanu lawyer also file application for im bail and di goment lawyer say dem need to look into di document.

Nnamdi Kanu for court wit im lawyers on Wednesday, 16, February 2022
Wetin we call dis foto, Nnamdi Kanu for court wit im lawyers on Wednesday, 16, February 2022

Wetin hapun for court on Wednesday

For court on Wednesday, goment lawyer Shuaibu Labaran bin inform di court say di defence counsel file and serve am two applications and e don respond to dem.

According to am, di first application dey seek order to quash di 15-count amended charge wey goment sama for Kanu head and di oda one di seek for im bail.

Labaran say im dey ready for business of di day. 

But wen e come Ozekhome turn, e complain bitterly say di DSS don refuse to allow Kanu change clothes wey dey contrary to di order of di court say e miust come court wit new cloth. Ozekhome say three times, DSS official no allow Kanu broda access to di facility wia dem keep am and dat since Kanu chop arrest, dem seize im eye glass

"My Lord, we demand say make dem give di reading glasses of di defendant back to am. "We no fit afford make im go blind" im argue.

Justice Nyako say im don hear di complain and direct Ozekhome to proceed with business of di day.

Defence lawyer, Ozekhome come say im get application wey im wan di court to troway, e say make dem strike out and dismiss di 15-count charge sake of say say e dey incompetent and deny di court jurisdiction to hear di mata.

For di application, with 34 grounds and wey dey supported by 36-paragraph affidavit, Ozekhome say, im dey also seek for order to acquit and discharge Kanu for want of jurisdiction and defective, baseless and incompetent charges.

Justice Binta on her part, come adjourn di mata and fix April 8 to rule on Kanu applications to throway di charge dem.

Justice Nyako also order DSS to find Nnamdi Kanu eye glass and give am back before di next court appearance.

Wetin we call dis Video, Exclusive interview with Kaduna state Governor Nasir El-Rufai

Amended charges wey Kanu dey face

Nigeria goment bin sama Kanu wit charges on alleged acts of terrorism and treasonable felony, den di office of di Attorney-General of di federation come amend di charges against Kanu wey dem file as motion on notice for di court.

Dis na di amended charges against Kanu:

•Say Kanu allegedly use im radio broadcast from London wia e boast to separate south east, south south and some parts of Kogi and Benue states from Nigeria to form Biafra land.

•Say Kanu allegedly use im radio broadcast from London abuse Nigeria President Muhammdu Buhari wen im call di president "paedophile, a terrorist, an idiot and an embodiment of evil."

•Say Kanu allegedly import Radio transmitter wey be TRAM 50L wey e hide inside container go keep for Ihiala, Anambra state.

•Say Kanu allegedly declare im sef as member of Indigenous People of Biafra (Ipob), group wey Nigeria goment don ban.

•Say Kanu allegedly commit terrorism wen e use di radio broadcast from London to encourage members of di banned Ipob to attack Nigeria security operatives and dia family members.

•Say Kanu allegedly commit terrorism wen e incite members of di public to kill police officers

•Say Kanu allegedly commit terrorism wen im boast say tins go happen and say pipo go die.

•Say Kanu allegedly use di Radio broadcast from London to commit act of terrorism wen e declare sit-at-home and threaten death on pipo wey no obey di order.

•Say Kanu allegedly commit terrorism wen e use im radio to incite pipo to stage violent revolution against di federal goment.

•Say Kanu allegedly commit terrorism wen e use im radio to direct members of di public to burn down goment facility for Lagos.

•Say Kanu allegedly commit terrorism wen e use im radio to incite di public to destroy public transport system for Lagos wey cause major economic loss.

•Say Kanu allegedly commit terrorism wen e incite Ipob members to manufacture bomb.

•Say Kanu allegedly commit terrorism wen e incite members of di public to stop di Anambra state election and destroy Nigeria political and economic structure.

•Say Kanu allegedly commit terrorism wen e issue deadly threat to anyone wey no obey di sit at home order to write im own will.

Nnamdi Kanu for court wit im lawyer

Wia dis foto come from, Ifeanyi Ejiofor/Facebook

Wetin we call dis foto, Nnamdi Kanu for court wit im lawyer

Timeline of Nnamdi Kanu Trial from 2015

October 2015: Dem arrest and arraign Kanu on top charges of treasonable felony, unlawful possession of arms, and illegal importation of broadcast equipment, for Federal High Court, Abuja.

October 2015: Kanu and im defendants deny di charges dem.

December 2015: Court order di release of Nnamdi Kanu but di federal goment refuse to comply.

December 2015: Di federal goment file anoda five-count charge of treasonable felony against di Ipob leader and for 2016, three courts rule say make dem lock am for Kuje prison, citing threats to national security.

May 2016: Nnamdi Kanu cari cry go ECOWAS Court and blame President Buhari say e no wan grant am bail.

April 2017: Di federal high court for Abuja come grant Kanu bail on 'health grounds.'

April 2017: Kanu come become free man once again afta dem detain am for 18 months.

September 2017: Kanu japa from Naija.

September 2017: Di lawyer wey dey represent Kanu say im neva yan wit im client since September 14, wen sojas invade im house for Imo state.

October 2017: Wen court resume di treason trial of Kanu, e no show.

June 2021: Di Federal goment repatriate Ipob leader to Nigeria to continue im trial. Nigeria Minister of justice na im announce say dem don catch am and return am back to di kontri.

Wetin we call dis Video, Kanu Lawyer reply Malami over fresh accuse

June 2021: Court order make dem lock am for SSS custody until July 26.

July 26, 2021: Court adjourn di case to October 21.

October 21: Dem bring Kanu come court wit plenti security and court adjourn to 10th November

November 10, 2021 Nnamdi Kanu lawyers stage walkout from di court afta SSS no allow some of di defence lawyers to enta di court room

November 10, 2021 Di presiding judge come move di case to 19, 20 of January, 2022

December 2nd, 2021: Di court hold an emergency session wia Nnamdi kanu lawyers ask di court to move di trial date forward and court agree and put am for January 18, 19, 20

January 18, 2022: Di presiding judge adjourn di case to 19 afta di prosecution file new charges

January 19, 2022: Kanu plead not guilty to di charges against am and di judge adjourn di mata to 16 of February to consider application to quash di charges against Kanu.