Nnamdi Kanu trial: Ipob leader Nnamdi Kanu court case adjourn until January 2022

Nnamdi Kanu

Wia dis foto come from, Ifeanyi Ejiofor/Facebook

Di trial of separatist leader of di Indigenous People of Biafra, Nnamdi Kanu don dey adjourned until 19th and 20th of January 2022.

Oga Kanu wey be di oga of di proscribed Ipob group make im third court appearance since June wen security agents bring am back to Nigeria from anoda kontri wey dem no mention.

Im lawyers stage walk-out before di judge enter di courtroom make di pronouncement.

Dis anger happun afta Nnamdi Kanu tell di Judge say one of e counsels from di United States, Bruce Fein bin no dey allowed to access di court by Nigerian secret police, Department of State Services.

Kanu, bin enter courtroom just before 10am. But im come notice say di DSS no allow oga Fein wey come from America to enter court.

Justice Binta Nyako ask Kanu if im go like continue wit di case, di Ipob leader say no unless dem allow Fein wey come to observe di case enter di court.

Bruce Fein
Wetin we call dis foto, Kanu bin tok say oga Bruce Fein wey be lawyer bin come court to observe tins

How Kanu lawyers react

"Wetin happen today no go well. Di judge be like she get problem wit di number of judges but dat one no concern her," na so special counsel to Kanu, Alloy Ejimakor tell BBC Pidgin.

"Mazi Nnamdi Kanu get right to im Lawyers and di constitution no tok say e must get only one Lawyer.

"Dis Nnamdi Kanu matter dey complicated and dat na why nothing wrong to get di number of lawyers wey we get.

"Say di court disregard section 36 of di constitution wey tok of right to fair hearing." E say dem go return to di drawing board

Anoda of Kanu Lawyers wey follow come di trial tell tori pipo say di Lawyers wey dey represent Kanu dey outside, "wia be di justice for dis matter, wia be di trial? E ask.

Di Lawyer wey represent Ohaneze Ndigbo add say, "wetin dem teach us be say judge dey sit independently. Apart from dat di law say dem must do justice in di presence of all make everybody see.

"DSS keep everybody outside including lawyers and old men wey dey dia 80s and 90s."

Wetin Nigeria goment accuse Kanu of?

Di Nigerian goment accuse di Ipob oga say im wan secession and also say im dey broadcast lies about President Muhammadu Buhari.

Dem also accuse am say e be member of group goment don outlaw. Most of di accuse dey based on di tins wey im allegedly tok for Radio Biafra wey dey broadcast from outside Nigeria.

Wetin be di charges wey dem bring against am?

"Nnamdi Kanu news today": [Ipob leader Nnamdi Kanu] 'Nigeria' manufacture 11 count charge against Ipob leader - Lawyer

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Nnamdi Kanu bin chop arrest for treason charges in 2015 before court grant am bail for April 2017

On Monday 18 October, goment add more charges to di three im dey face so dis na di amended charges dem.

  • Say Kanu allegedly use im radio broadcast from London wia e boast to separate southeast, southsouth and some parts of Kogi and Benue states from Nigeria to form Biafra land.
  • Say Kanu allegedly use im radio broadcast from London abuse Nigeria President Muhammdu Buhari wen im call di president "paedophile, a terrorist, an idiot and an embodiment of evil."
  • Say Kanu allegedly import Radio transmitter wey be TRAM 50L wey e hide inside container go keep for Ihiala, Anambra state.
  • Say Kanu allegedly declare im sef as member of Indigenous People of Biafra (Ipob), group wey Nigeria goment don ban.
  • Say Kanu allegedly commit terrorism wen e use di radio broadcast from London to encourage members of di banned Ipob to attack Nigeria security operatives and dia family members.
  • Say Kanu allegedly commit terrorism wen im boast say tins go happen and say pipo go die.
  • Say Kanu allegedly use di Radio broadcast from London to commit act of terrorism wen e declare sit-at-home and threaten death on pipo wey no obey di order.

Wetin be im plea?

On Thursday, 21 October, Nnamdi Kanu plead not guilty to all di charges dem bring come against am.

E bin also apply make court comot am from DSS custody put am for correctional centre, but court shut di application down.

Wetin happun di oda times dem bring Kanu come court?

"Nnamdi Kanu news today": [Ipob leader Nnamdi Kanu] 'Nigeria' manufacture 11 count charge against Ipob leader - Lawyer
Wetin we call dis foto, Nnamdi Kanu on 29 June, 2021 after im arrest and return to Nigeria.

For im last court appearance on 21 October, Nnamdi Kanu bin plead not guilty on di terrorism charges wey di Nigerian goment sama for im head.

Dis na afta Nigeria goment wey Minister of Justice, Abubakar Malami lead amend some of di charges against Kanu

Di first time im bin show for court since im return di kontri na for June 29, wen Justice Binta Nyako order detention of Kanu for Department of State Services (DSS) facility.

Which kain punishment im fit face?

Former Chairman of NBA OCJ Okocha and Marshal Abubakar tok say, f dem find am guilty of di charge of treasonable felony, Nnamdi Kanu go face di capital punishment wey be death penalty.

Dis na because around di world, treason na di highest civil offense wey pesin fit commit.

And e carry death penalty as di maximum sentence and e fit also carry life in prisonment

For Nigerian Law, no right dey for any part to divide or breakaway.

So pesin wey engage for dat kain agitation for cessation, di pesin dey engage in a treasonable offence.