Senegal vs Equatorial Guinea: Highlights of Afcon 2021 quarter final game

Wia dis foto come from, Getty Images
Senegal win Equatorial Guinea 3-1 to book a spot for di Afcon 2021 semi - finals for Cameroon.
Na dem be di favourite to win di game despite say dem bin never impress so far.
Senegal go now face Burkna Faso for di semi finals.
Aliou Cisse side bin don only score three goals - but dem never concede. Before now, injury-time Sadio Mane penalty na dia only goal for di group stages - and Mane and Bamba Dieng score as dem beat Cape Verde for di last 16.
Equatorial Guinea, wey rank 114th for di world, be surprise quarter-finalists.
Dis na dia third time for di Africa Cup of Nations - although dem reach di semis for 2015.
Check out how di game hapun live.

Wia dis foto come from, Getty Images
First Half
1 Min: KICK-OFF
End of Di one wey oda users dey read well well
Senegal 0-0 Equatorial Guinea
Game don start. We go see one of di great Afcon shocks?
3 Mins: Both keepers get early touch of di ball and Senegal Famara Diedhiou half-volley wide long afta di whistle bin go for a free-kick.
4 Mins: First shot of di game as Equatorial Guinea Iban Edu make effort over from 20 yards out.
8 Mins: Emilio Nsue cross for Equatorial Guinea and Iban Ebu get ready to head am for di centre but di ball no reach am.
9 Mins:
YELLOW CARD
Equatorial Guinea defender Carlos Akapo catch Saliou Ciss elbow for face and di Senegal player get yellow card.
Akapo roll for ground small and di physios come on.
10 Mins: E don come back on and im team get corner afta some great work from Emilio Nsue.
11 Mins: Senegal clear from di corner but Sadio Mane no fit mount counter-attack.
12 Mins: Sadio Mane come down 30 yards out. Chance dey to shoot from dis free-kick?
14 Mins: Idrissa Gueye step up to take di free-kick. E no work.
16 Mins: As e be say you no go fit tell which of these teams suppose be di mega-favourites.
17 Mins: Senegal full-back Saliou Ciss go down di left but dem head im cross away. Dat free-kick na dia only shot so far.
Now dem get a second shot as Boulaye Dia effort dey blocked from Sadio Mane cut-back.
18 Mins: Senegal second booking as Pape Gueye get yellow card for stopping one counter-attack.
22 Mins: First shot on target as Senegal Famara Diedhiou control a long ball, den drag im low effort wey Jesus Owono hold onto.

Wia dis foto come from, Getty Images
26 Mins: Notin much dey happen really. Equatorial Guinea win free-kick sha.
28 Mins: GOAL!
Senegal 1-0 Equatorial Guinea
Senegal take di lead.
Sadio Mane play one nice through ball to Famara Diedhiou wey run in behind di defenders and hammer in low shot into di near bottom corner.
33 Mins: Saliou Ciss cross dey stopped and di favourites suddenly ldey look good.
35 Mins: Equatorial Guinea just dey hang on now. Sadio Mane get di ball and put am across di six-yard box. Na definite goal unless player in red get dia first, and na wetin hapun be dat
37 Mins: YELLOW CARD!
Na only 1-0 so Equatorial Guinea need to not lose dia heads here. Jose Machin shoulder Pape Gueye for di back and e collect.
38 Mins: Senegal Leicester holding midfielder Nampalys Mendy put in in a long-range shot wey nobody dey expect but Jesus Owono catch am.
42 Mins: Dem really dey hang on now. Plenti tackles and desperate defending as dem try to get through to half-time.
44 Mins: Equatorial Guinea get a free-kick in shooting range as Idrissa Gueye catch Pablo Ganet 22 yards out.
45 Mins: Pablo Ganet slam di free-kick straight into di wall. Na waste. E call for handball but referee say no.
HALF-TIME
Senegal 1-0 Equatorial Guinea
Half-time whistle go off. So far, so good for Senegal but Equatorial Guinea still dey di game.
SECOND HALF KICK-OFF
46 Mins: Senegal 1-0 Equatorial Guinea
Second half don start.
47 mins
YELLOW CARD
Sadio Mane dey fouled by Saul Coco second afta di restart and Coco collect yellow.
Idrissa Gueye shoot di free-kick well over from distance.
49 Mins: Equatorial Guinea just find a bit of composure but dem go need to create more chances.
50 Mins: Haa! Iban Ebu flick one cross comot di hand of Kalidou Koulibaly. Penalty.
51 Mins: Video Assistant Referee
Di referee go di monitor. How far di defender arm bin dey from im body? E no dey very far.
52 Mins: NO PENALTY
Relief for Senegal. Dem overturn di penalty decision.
53 Mins: E dey close range and di arm bin dey very near di body. Dat na why dem no give am - but dem don give penalties for am before.
Equatorial Guinea players still dey complain about dat decision.

Wia dis foto come from, Getty Images
57 Mins: GOAL!
Senegal 1-1 Equatorial Guinea
Equatorial Guinea equalise from open play.
Pablo Ganet pick out Jannick Buyla for di box. E control di ball with im left and hammer am across di keeper into the far bottom corner with im right.
59 mins: SUBSTITUTION
Senegal 1-1 Equatorial Guinea
Senegal bring on Ismaila Sarr for im return from a knee injury. Dis na im first game since Watford 4-1 win over Manchester United for November.
Boulaye Dia dey replaced.
60 Mins: Half an hour away from extra time.
61 Mins: Emilio Nsue dey desperately close to turning home Carlos Akapo ball across di box for di back post. E stretch but e just no fit reach am. Dis na complete turnaround now.
64 Mins: Pape Gueye shoot just wide from outside di box for Senegal. Dat na dia first chance in a good while.
66 Mins: SUBSTITUTION
Senegal bring on Crystal Palace Cheikhou Kouyate and Bamba Dieng for goalscorer Famara Diedhiou and Pape Gueye.
68 Mins: GOAL!
Senegal 2-1 Equatorial Guinea.
Equatorial Guinea make mistake of clearing one corner and dem give Senegal di lead.
Two defenders try to head am clear but dem just put di ball behind dem inside di way of Cheikhou Kouyate, who put im foot up high to put am past di keeper with one of im first touches.
71 Mins: Basilio Ndong cross dey blocked and dem get some more balls into di box.
73 Mins: SUBSTITUTION
Federico Bikoro replace Pablo Ganet for Equatorial Guinea.
75 Mins: Na 15 minutes away from a Burkina Faso v Senegal/Egypt v Cameroon final four.
78 Mins: Equatorial Guinea done do themselves proud here. Emilio Nsue just no fit control one ball on di edge of box di and Senegal fit get away.
79 Mins: GOAL - Senegal 3-1 Equatorial Guinea
Ismaila Sarr score im his first game of football since November.
Saliou Ciss pull di ball across di box and Sarr get straightforward finish from close range.
84 Mins: SUBSTITUTION
Equatorial Guinea sub Ruben Belima, former Real Madrid C player, get in behind but dem cut im cross out.
85 Mins: SUBSTITUTION
Alex Balboa replace Jose Machin for Equatorial Guinea. Na di 20-year-old first gametime for dis tournament.
87 Mins: Ismaila Sarr drive one 25-yard shot just over di bar.
90 Mins: INJURY TIME
Senegal 3-1 Equatorial Guinea
Three minutes dey added on.
Senegal bin don only scored three goals for dia previous four Afcon 2021 games.
90+1 Mins: Ruben Belima shoot over from distance for di underdogs.
90+3 Mins: Anoda effort from range over, dis time Jannick Buyla. Time don finish.
FULL-TIME
Senegal 3-1 Equatorial Guinea
E don over. Senegal go face Burkina Faso on Wednesday for a place in di Africa Cup of Nations final - as dem bid for dia first ever title.














