Egypt vs Morocco: Highlights from Afcon 2021 quarter final game

Mo Salah and im colleague hug

Wia dis foto come from, Getty Images

Egypt beat Morocco 2 -1 for Sunday Afcon 2021 quarter-final game to set up dia place in di semi finals of di tournament.

Mohamed Salah score equaliser afta Sofiane Boufal early penalty bin give Morocco di lead.

Salah den play ogbonge role for Egypt second goal - e set up Trezeguet, wey score wetin prove to be di winner.

Dem go face Cameroon for di semi-finals.

Egypt na di most successful nation for di history of di Africa Cup of Nations, dem don win am for seven occasions, most recently for 2010.

Morocco bin don also lift di trophy, with dia single success tori from way back in 1976.

Check out how di match play live.

Mohammed Salaha and referee for di Egypt vs Morocco game

Wia dis foto come from, Getty Images

LIVE UPDATES

I Min: Egypt 0-0 Morocco

E don start Morocco dey get us started.

2Mins : Na Bright start for Morocco. Ayman Ashraf fit don concede very, very early penalty, e slide in on Achraf Hakimi.

e look like say na fowl inside di box 18.

Referee Maguette Ndiaye go look am for VAR. E fit be di start Morocco need.

PENALTY to Morocco

Ayman Ashraf don concede penalty. E wipe out di legs of Achraf Hakimi with one sliding challenge.

6 Mins: GOAL - Egypt 0-1 Morocco

Sofiane Boufal na im score di penalty.

Beta start for Morocco and a very cool penalty from Sofiane Boufal.

Mohamed Abo Gabal for di Egypt goal dive to im right, Boufal slot in im penalty for di oda side and Morocco, afta only six minutes, take di lead.

9 Mins: Mohamed Salah swing in a corner from di right but Yassine Bounou for di Morocco goal show some confidence, e come off im line to punch am clear and clear di danger.

13 mins: Sofiane Boufal wey don already get one goal dey look for anoda as e strike from di edge of di penalty area, but e dey deflected behind off Egypt defender Mohamed Abdelmonem.

19 Mins: Egypt get free-kick 35 yards out but e dey deflected well over di top.

Mohamed Salah corner enta good area, but no-one dey run in to get am.

21 Mins: Egypt get strike at goal from Ayman Ashraf, di man wey concede di penalty, from 25 yards out. Yassine Bounou for di Morocco goal dive to im left and push am comot wit im two-handa, although e for fit dey able to hold am.

E stay out sha. Better from Egypt though.

26 Mins: Omar Kamal produce one clumsy sliding challenge on Sofiane Boufal. Di Egypt man pick up a yellow card for im effort.

32 Mins: Arsenal Mohamed Elneny concede one foul and come begin dey argue for di face of referee Maguette Ndiaye.

Egypt dey one goal down, so di last tin dem need na to go one man down due to lack of self-control.

Luckily for Elneny, he doesn't talk himself into trouble.

34 Mins: Paris St-Germain man Achraf Hakimi take di free-kick just outside di penalty area, e take am over di wall but e go just wide of pass di Egypt goal.

41 Mins: Morocco don get just one shot on target, and na dem dey lead. But Egypt demsefs don only get two. So far, di Moroccan defence don quiet Mohamed Salah.

43 Mins: Mohamed Salah remain on corner duty, maybe e go beta for am to dey di box and let someone else take dem.Yassine Bounou gada im latest effort, above im head for di penalty area wey full.

Good solid, confident keeping from di Moroccan number one.

45 Mins: First half don end.

Egypt vs Morocco

Wia dis foto come from, Getty Images

SECOND HALF

Second half don start.

If no more goal hapun, e go be Morocco wey go face Cameroon for di semi-finals.

50 Mins: Trezeguet don only dey pitch for a couple of minutes and nearly make instant impact.

Na great play from Mohamed Salah on di edge of di penalty area as e dey surrounded by three defenders but fit still find Trezeguet and di Villa man take a touch to set imself and fire at di goal with im second. E go wide.

53 Mins: GOAL!

Mo Salah don equalise for Egypt.

Mohamed Salah convert one rebound from close range afta Mohamed Abdelmonem diving header from one corner dey saved by Morocco goalkeeper Yassine Bounou

Game on now!

63 Mins: Brilliant from Wolves defender and Morocco captain Romain Saiss to keep am at 1-1.

Egypt Omar Marmoush, run to catch one long ball forward, dey just about to strike goal before Saiss come from nowhere, slide in and win di ball clean.

Top-class defending from Saiss.

71 Mins: Mohamed Abdelmonem of Egypt goes down holding his face. Hard to see why. There was nothing there. Romain Saiss was the nearest man to him, but hadn't done much wrong.

75 Mins: Mohamed Abdelmonem of Egypt go down as e dey hold im face. Notin really dey dia. Romain Saiss na di nearest man to am, but e no do much wrong.

78 Mins: E son dey dey somehow for here. One kasala burst wey involve almost everyone. Plenti push-push, not too much control.

E all begin with Achraf Hakimi wey grab di shirt of Mostafa Mohamed wey face up to di Morocco man and e come become like a free-for-all afta dat.

Afta everytin, na yellow for Hakimi, yellow for Mohamed.

Everyone else get warning to calm down and continue.

80 Mins: Di palava come just afta Morocco get a free-kick to di right of di penalty area and Munir El Haddadi strike goal but Egypt goalkeeper Mohamed Abo Gabal punch am out.

Ten minutes to go of normal time. If we no get a goal, e go go to extra time.

82 Mins: Morocco dey so close to regaining dia lead.

Na header at goal from Nayef Aguerd on di six-yard line and na brilliant reflexes from Mohamed Abo Gabal wey spring imself in di air and push di ball on to di crossbar and e bounce clear.

85 Mins: But that save from Mohamed Abo Gabal has cause am some harm. E need some attention and e be like say e fit don pull muscle for im thigh area.

90+2 Mins: We get five minutes of injury time. And Mohamed Abo Gabal, wey hold Gabaski on di back of im shirt, look like e no fit continue.

Na di third time we don get a stoppage and e don receive attention again, but e still dey out dia. Mohamed Sobhi suppose come on, but im time never come yet.

90+3 Mins: Morocco, for di 93rd minute, win corner. A goal now fit be di winner, but di corner from di left no convert to anytin and di chance waste.

90+4 Mins: Egypt goalkeeper Mohamed Abo Gabal no dey move too freely, but e still dey out dia and manage to kick di ball from im hands and set up a counter attack. E find Mohamed Salah, but e dey crowded out by di Morocco defenders.

Mo Salah colleagues carry am afta e score

Wia dis foto come from, Getty Images

EXTRA TIME

Egypt 1-1 Morocco

Mohamed Salah equaliser force extra time afta Morocco take an early lead with Sofiane Boufal early penalty.

91 Mins: Mohamed Abo Gabal, wey injure imself as e make ogbonge save to keep out Nayef Aguerd header, still dey out dia.

96 Mins: Egypt boss Carlos Quieroz don finally lose patience with goalkeeper Mohamed Abo Gabal, who, despite say e struggle to move for 10 minutes, now don dey finally replaced. E limps off slowly.

Third-choice goalkeeper Mohamed Sobhi dey on for Egypt.

100 Mins: GOAL!

Mohamed Salah score di first - and e don make di second.

Di Liverpool man sprint down di right wing, e produce a brilliant, inviting ball across di face of di Morocco goal.

Aston Villa Trezeguet dey dia for back post and e keep im composure to calmly finish from close range and Egypt dey close in on di final four.

105: Mins: Mohgamed Abdelmonem get yellow card, e bundle Soufiane Rahimi to di ground, just outside di penalty area. Achraf Hakimi take am but e send am over di top in di last action for di first half of extra time.

Egypt dey 15 minutes away from di semi-finals.

EXTRA TIME SECOND HALF

106 Mins: Right, here comes di second half of extra time. Morocco need to score or dem dey go home.

110 Mins: Achraf Hakimi make run down di right wing but e dey too much on di cross and e go harmlessly out of play for Morocco. E bin wan corner, di ref say goal kick.

112 Mins: Morocco get about 10 minutes to find di goal wey go take us into a penalty shootout. Sofyan Amrabat try im luck from distance, but na complete waste.

115 Mins: Morocco dey push men forward. Cameroon sit and wait to see who dem go meet for Thursday semi-final.

116 Mins: Morocco get five minutes to save demsefs.

119 Mins: Morocco Soufiane Rahimi cut inside on to im right foot and strike at goal, but e dey far, too far out and na di wrong option, di ball face di fans. Time dey run out.

Free-kick for Morocco. Now or never.

Morocco goalkeeper Yassine Bounou go forward for di free-kick.

Egypt fit counter, di keeper no dey ...

Egypt somehow mess am up. Di keeper still dey di oda half. Three against one and Egypt somehow no score.

Mohamed Salah comot for di last few seconds, substitution.

FULL-TIME

Egypt 2-1 Morocco

Egypt move into di semi-finals of di Africa Cup of Nations and go play Cameroon on Thursday.