Salvation ministry: Police confam three dead for Delta building collapse

Wia dis foto come from, Choice TV online
Police for Delta State for Nigeria south-south don confam say three pesins don die from di storey building collapse wey happen for Okpanam road wey dey di capital, Asaba.
Delta State Police tok-tok pesin DSP Bright Edafe confam to BBC Pidgin say, "as at yesterday night wen di incident happun, dem rescue 18 pesins out of di building and three pipo bin dey critically injured but as at dis morning, three pesins dey confam dead."
DSP Edafe say no be true say na 10 pipo wey die as some pipo dey report come add say rescue efforts still dey go on for di site of di church building collapse as emergency services still full ground.
E explain say di Church bin dey hold di service upstairs so di building no collapse on top di pipo so some of dem come out from di building.
Who own di building wey collapse?
Salvation Ministries for statement say "dem dey aware of di incident and di church occupy di first floor [of di building], togeda wit oda tenants wey occupy di ground floor".


Di incident happun for di evening hours of Tuesday, tori be say di Church bin dey hold service to mark dia 21-days fasting and prayer activities.
Di church say dem currently dey work wit relevant authorities to investigate di cause of di incident.
Meanwhile di Delta State Emergency Management Agency, fire service and police dey di scene of di incident as dem dey check if pipo still trap inside di building.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, LASEMA
Incidents of building collapse na something wey dey happun more often for Nigeria.
For 1 November 2021, 21 storey building collapse for Ikoyi area of Lagos wia up to 44 pipo bin die according to di Lagos State Emergency Service.
According to Construction experts, many buildings for Nigeria dey collapse becos of sub-standard materials, negligence and breaking of construction regulations.
See fotos from di building collapse
















