Nigeria kidnappings: Police, DSS, Army storm Imo, Anambra camps of alleged cannibals

Wia dis foto come from, DSS
Joint security forces wey raid kidnapers camps for eastern Nigeria discover wia pipo allegedly dey chop human flesh.
Di team of Nigeria military, police and Department of Security Service (DSS) storm di camps inside two states for south east of di kontri.
Director of DSS for Imo State, Wilcox Idaminabo say di operation happun for Orsu local goment for Imo state and Uli for Ihiala local goment area for Anambra state.
Idaminabo wey be oga of Nigeria secret police for Imo bin speak on behalf of di joint security team.
Di kidnapers sack one community each for Orsu and Ihiala local goments grab some of di lands for demsef.
"Wen we get dia we notice say di community dey abandoned and dis boys don take over di community, dem carve out lands for demsef and dat na anoda brand of insurgency.
"Di place na just ghost town, everybody don disappear for dis towns," Di DSS oga tok.
During di raid, di team rescue Eze Iheanacho Ndukwe from Okigwe, wey dem bin kidnap some days ago.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Idaminabo say dem also discover plenty human parts scatter all over di place.

Wia dis foto come from, Imo Police
But dat no be di only tin wey dem discover.
"Surprisingly for dis 21st century, we notice say pipo dey practice cannibalism - eating of human flesh - here, becos wey see human flesh wey dem dey roast," Idaminabo tok.
Imo State govnor Hope Uzordinma for im reaction to di security operations describe di criminals as cannibals and bandits as im express im joy ova di arrest.
"At least Imo pipo go come home to celebrate Christmas. We dey wonder how we go abandon one entire local goment like Orsu local to di hands of criminals and cannibals, wey dey eat human beings and roast human beings," di Govnor tok.
Oda tins wey dem recover na plenty cars and many dead bodies.
Di security forces arrest some of dem afta both sides attack each oda for some time.
Na some 30 suspected kidnappers and criminals chop arrest for Imo state, according to report.
Na dring di Monday raid on camps inside Orsu local government and Uli community in Ihiala local government area of Anambra state.
One traditional ruler wey dem bin kidnapp inside Okigwe local goment area on Sunday, Acho Ndukwe of Ihube autonomous community bin dey released during di raid.
Kidnapping in Nigeria
One of di most fearful threats for families inside Nigeria nowadays na di frequent kidnapping of pipo, including schoolchildren from dia classrooms and boarding houses.
More than 1,000 students don dey kidnapped from dia schools since December 2020, many only released afta aft payment of randsom wey cost upto thousands of dollars.
Some of di kidnappers dey commonly referred to as "bandits" in Nigeria.
Dis ones dey raid villages, kidnap civilians and burn down houses.
Attacks by bandits don force thousands of pipo to even flee dia homes and seek shelter in oda parts of di kontri.
From north to south to west, east to north na thousands of pipo lives don lost across Nigeria sake of kidnappings since 2012.
And attacks still dey go on. Hundreds of schools up north don dey closed following abductions at schools inside Zamfara and Niger state, wia children dem sieze as young as three years old.
By every indication, Nigeria lucrative kidnapping industry dey boom - e dey expanding into previously safe areas.
And di mata don dey look like say e dey beyond di control of di kontri military and security forces.
E don pose a real threat to trade and education, as well as di kontri farming communities.














