Kabiru Alhassan: Kano professional firewood cutter wey get one hand

Wetin we call dis Video, Kabiru Alhassan na one hand professional firewood cutter

Kabiru Alhassan lose one of im hands 22 years ago afta im and im friends climb tree wen dem travel from Kano city for north west Nigeria go village.

For dis interview with BBC Pidgin, Kabiru tori how di incident hapun, im journey to healing and how e become a professional wood cutter with just one hand.

Video by: Mansur Abubakar. Chukwuemeka Anyikwa