Youβre viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Akuapem Poloo: Why Ghana actress Rosemond Brown dey go back to jail
Ghana Social media sensation, Rosemond Alade Brown Aka Akuapem Poloo dey go back to jail to continue en 90 day jail sentence.
Dis be after High Court for Accra dismiss en appeal today, Wednesday, 1 December 2021.
Around July last year, Akuapem Poloo bin enter wrong side of de law after she post nude photo of herself and son online as part of en seventh birthday.
Because of dis Accra Circuit Court sentence her to three months in prison for April 2021 but after her lawyer file for appeal court come grant am bail.
But for today hearing of di case, High Court for Accra dismiss de appeal wey Akuapem Poloo file to challenge de jail term.
According to presiding judge, Justice Ruby Aryeetey de sentence den give am no be excessive, sake of dat dem no go interfere plus am.
"De court only go interfere if de sentence be excessive" she add.
She follow dis reasoning dismiss de appeal.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis mean say Akuapem Poloo dey go back to prison to continue serving de jail term wey de Circuit court give am for April.
Meanwhile for her social media handle, Akuapem Poloo don send message of support give her son;
"Son I love you and God dey with you always you know ππππππBe good till mummy comes back π God dey in control always."
How Akuapem Poloo land jail sentence
Accra Circuit Court for April dis year sentence Ghanaian actress, Rosemond Brown to three months in prison.
De Court argue say de reason for de punitive sentence be sake of dem wan use dis case serve as deterrent to de general public.
De court also reveal say de pregnancy test of de accused be negative.
De reason for en sentence be sake of around July last year, she post nude photo of herself den son online as part of en seventh birthday.
She plead guilty to three charges wey de court level against am which dey include - de publication of obscene materials, engaging in domestic violence in ways which dey undermine de privacy and integrity of another person and finally engaging in domestic violence which go fit spoil de dignity of another human being.
Who be Akuapem Poloo
Akuapem Poloo wey her real name be Rosemond Alade Brown na Ghana Actress, video vixen and get huge presence for social media.
De Ghanaian actress rise to limelight through social media where she dey entertain people.
Dem born am on 1st June, 1989 for Suhum, Eastern Region of Ghana.
She attend Suhum Roman Catholic School wey she continue to Ofori Panyin School. She later continue to Adonten Senior High school.
Later she move to Accra to pursue en acting dreams, but she find fame for social media after en twerking videos start dey go viral.
Akuapem Poloo wey be singer mother born her first son at age 24, but she no dey plus de man.
Out of de fame, she start dey act movies until she recently branch into business.
Akuapem Poloo dey call hersef Ghana Cardi B base of di strong love likeness wey she get for de American singer.
Cardi B describe am as en twin sister for Ghana after POLOO impress am during en visit to Ghana.
And for some occasion, Cardi B don chook mouth for mata wen concern Akuapem Poloo. Di American singer bin tok one time say di prison sentence dey too harsh as punishment for Akuapem Poloo.