Jos prison break: Officer, odas die for Medium Security Custodial Centre attack for Plateau state

Pipo gada for di front of di prison afta di attack

Wia dis foto come from, Deborah Sati Kesmen

Wetin we call dis foto, Pipo gada for di front of di prison afta di attack

At least 10 pipo don die and several odas sustain gun wound afta gunmen attack di Medium Security Custodial Centre for Jos, Plateau State north central Nigeria.

According to di statement wey di tok-tok pesin for di correctional facility OF Enobore sign, one prison officer plus 9 inmates na dem die for di attack.

E explain say one officer plus six inmates bin wunjure during di attack and 262 inmates bin escape but dat dem don recapture 10 of dem.

Jos Medium Security Custodial Centre before di attack get 1060 inmates, 560 of dem na pre trial detainees and 500 of dem na convicts.

Gunmen bin attack di Custodial Centre around 5:20pm and immediately head for di main gate where dem engage di armed squad personnel for gun battle before dem break enta di yard.

Oga Enobore say di attackers and di inmates bin escape before dem get re-enforcement from oda sister security agencies to come epp dem.

E further yarn say one of di gunmen wey trap inside di custodial centre dey among those wey dem kill during di gun battle.

Di controller General of Corrections, Haliru Nababa don condole wit di family of di officer wey die for di attack and promise say im death no go dey in vain and dat dem go make sure say dem hunt down those wey cari out di jail break and make dem face di law.

One eyewitness tell BBC Pidgin say dem plenty wey come.

"I see pipo dey run, you know say dis na festive season and you fit dey hear knock-out sound, but dis one dey different. Dem dey in dia hundreds and dem dey run, some dey young, some old and some dey in di middle.

I see one wey dem shoot for hand as e dey try to cover am, Some run come our house side dey look for where to hide, say make we hide dem. Di barracks no dey fenced. Some don go di river side wey dey for di barracks, some dey hide for inside di bush."

Di correctional service

Wia dis foto come from, Samson Omale

No be di first prison break attempt dis year

Dis no go be di first time dis year wey gunmen dey attack prison facilities for Nigeria.

For October, two pipo die and prisoners escape wen gunmen attack di Abolongo Custodial Centre of di Nigeria Correctional Service, Oyo state for southwest Nigeria.

Di Nigerian Correctional Service (NCoS) for Imo state confam for April dis year say 1,844 inmates escape from di Owerri prison afta gunmen attack di prison.

For inside statement wey di NCoS spokesman, Francis Enobore release, e say di gunmen wey dem still dey find bin use explosives blast administrative block wey dem make fit enta di prison yard.