You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Aminata Diallo: Paris St-Germain player dey under arrest as part of investigate into attack on her team-mates
French police don arrest Aminata Diallo, one midfielder wit Paris St-Germain women team.
Di police say na part of investigation into attack on di club players wey happun on November 4, 2021.
Dem arrest 26 year old Diallo on Wednesday morning.
Di France international bin play during di PSG 4-0 win over Real Madrid for di Women's Champions League on Tuesday.
For inside statement, di club say dem dey work wit di police "to torchlight wetin be facts".
Di club also condemn di violence, say dem don take all necessary measures to guarantee di health, well-being and safety of players" since di attack happun.
Reports for France suggest say one of di players wey come under attack na Kheira Hamraoui, wey two masked pesin allegedly drag out of her car and beat up her legs.
Diallo, wey dem don cap seven times for France, join PSG for 2016 and don appear more dan 60 times for di club.
End of Di one wey oda users dey read well well
She spend time on loan for Atletico Madrid last season.
Who be Aminata Diallo
Aminata Diallo na French footballer. She originally come from Guinea.
Dem born her on April 3, 1995.
She dey play as midfielder for Division 1 Feminine club of Paris St-Germain women team
She bin sign two season contracts wit di club.
She receive some accolades as di UEFA Women Champion LeaGue runner-up fOr 2016.
For November 2021, Diallo team mate, Kheira Kamraoul dey attacked for street, two men drag her comot for her car assault her.