You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Facebook change company name to Meta for major rebrand
Facebook don change im corporate name to Meta as part of one major rebrand.
Di company say e go beta "encompass" wetin im dey do, as e dey broaden dia reach beyond social media into areas like virtual reality.
Di change no apply to dia individual platforms, like Facebook, Instagram and Whatsapp, only di parent company name change.
Di move follow series of negative stories about Facebook, based on documents wey one of dia former employer leak.
Frances Haugen accuse di company of putting "profits over safety".
'Our company now na Meta'
Facebook boss Mark Zuckerberg announce di new name afta dem reveal plan to build one "metaverse" - one online world wia pipo fit play game, work and communicate for one virtual environment wit use of VR headsets.
E tok say di existing brand no fit "really represent everytin wey we dey do today, let alone for di future", and im need to change.
"Over time, I hope dem see us as a metaverse company and I wan anchor our work and our identity on wetin we dey build towards," Im tok for one virtual conference.
End of Di one wey oda users dey read well well
"We now don dey look at and report on our business as two different segments, one for our family of apps, and one for our work on future platforms.
"And as part of dis, time don come for us to adopt one new company brand to carry everything wey we dey and reflect who we be and wetin we hope to build.
"I dey proud to announce say as from today, our company now na Meta."
To outsider, metaverse fit look like a version of VR, but some pipo believe e fit be future of di internet.
Instead of make pipo dey on computer, pipo for di metaverse fit use one headset to enta virtual world wey go connect all kain digital environments.
Dem hope di virtual world fit dey useful for practically anything from work, play and concerts, to socialise wit friends and family.