Kanye West new haircut spark reactions as di American rapper officially change im name

Kanye West New Haircut:

Wia dis foto come from, Instagram

Read am in 3 mins

Pipo dey tok about di new Haircut of American artist wey formerly dey known as Kanye West but now don officially change im name to Ye.

Dis na afta di rapper show off im new haircut for e Instagram handle afta changing im name to "Ye".

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

One Los Angeles judge grant di rapper name change request, one communications officer for di Los Angeles Superior Court confam.

Ye wey be 44-year-old start to file di request for August, citing "personal reasons."

E bin already dey use Ye as nickname and for 201, e use di name as album title.

Just immediately afta e release di album, e tweet say: "Di being formally known as Kanye West. I am YE."

But now e don make am official and e former full name - Kanye Omari West - no dey in use anymore.

No be only Kanye West be di first artist wey don change im name, odas like Prince, Snoop Dogg and Sean Love Combs don change dia names ova di years, some several times.

How Pipo react to Ye new haircut

Kanye West New Haircut

Wia dis foto come from, Getty Images

Afta Kanye share di picture of im new hairstyle, many pipo begin dey wonder about wetin dis means, while odas dey busy troll di rapper new look.

Ye come even once again become di subject of trolls and memes for Twitter as im new hairstyle na im pipo come dey discuss.

Some of e fans don advise odas not to make fun of di rapper by pointing out di fact dat di strange haircut fit be result of mental breakdown.

One user don even compare am to Britney Spears meltdown wen she shave off her head.

"Dis no be di exact haircut Britney give hersef wey put her up in conservatorship?" One twitter users ask.

Anoda twitter user write say;

"Pipo need to stop making fun of #KanyeWest. Di man get bipolar, e dey mentally ill. Weird masks, name changes, and terrible haircuts na sign say e dey experience manic episode and need help/med management."

While anoda one say; "Dis man need prayer. cause dis no be am RT @TheShadeRoom: OHKAY! Kanye West showin' off im haircut."

See oda reactions;

Kanye West New Haircut: Reactions as Kanye West reveal new haircut and change name

Wia dis foto come from, Twitter

Kanye West New Haircut: Reactions as Kanye West reveal new haircut and change name

Wia dis foto come from, Twitter

Kanye West New Haircut: Reactions as Kanye West reveal new haircut and change name

Wia dis foto come from, Twitter

Kanye West New Haircut: Reactions as Kanye West reveal new haircut and change name

Wia dis foto come from, Twitter

Kanye West New Haircut: Reactions as Kanye West reveal new haircut and change name

Wia dis foto come from, Twitter

Kanye West New Haircut: Reactions as Kanye West reveal new haircut and change name

Wia dis foto come from, Twitter

Kanye West New Haircut: Reactions as Kanye West reveal new haircut and change name

Wia dis foto come from, Twitter

Ye hit di headlines early dis year afta e split up with wife of nearly seven years, Kim Kardashian.

Di couple, wey get four children togeda, na among di most recognisable star for di world. Dia marriage be one of di most closely followed celebrity partnerships of recent years.