UK travel advisory: Abia, Rivers, Delta and di 18 states UK warn citizens not to go for Nigeria inside latest update

Di Foreign, Commonwealth & Development Office (FCDO) for UK don advise dia citizens make dem no travel to some areas for Nigeria for inside di latest travel advisory dem release.

UK togeda with oda kontries dey update and release travel advisory from time to time to help citizens wey wan travel with di latest information about di areas dem wan travel go.

According to di Head of Communications, British High Commission Nigeria, Dean Hurlock, di aim of goment travel advice through di FCDO, na to provide British nationals with ogbonge information and advice so dat dem go fit make correct decisions about international travel so dat dem go avoid palava wen dem travel.

For di updated travel advisory as at di time of dis report, from Saturday 16 October, 2021, UK authority warn citizens to avoid some areas for di West African kontri.

According to FCDO, dis na sake of security threats, increase in protests and demonstrations wey dey happun for dis areas.

Dem also cite attacks and targeted killings for di South East and South South regions of Nigeria. Dem say some of dis attacks dey happun for isolated roads and for remote locations, but chances dey say e fit happun for metropolitan areas.

Na 21 states out of di kontri 36 states dey di updated list.

Dem divide di travel advisory into two categories.

First set na states wey dem advise citizens against all travel and e include:

  • Borno State
  • Yobe State
  • Adamawa State
  • Gombe State
  • Kaduna State
  • Katsina State
  • Zamfara state
  • riverine areas of Delta, Bayelsa, Rivers, Akwa Ibom and Cross River States

For di second set, di FCDO advise against all but essential travel to dis states:

  • Bauchi State
  • Kano State
  • Jigawa State
  • Niger State
  • Sokoto State
  • Kogi State
  • within 20km of di border wit Niger in Kebbi State
  • Abia State
  • non-riverine areas of Delta, Bayelsa and Rivers States

Dem also draw ear give UK citizens wey dey for Lagos and Abuja to monitor local media and avoid any demonstrations or large gatherings.

"Events to mark di one year anniversary of #EndSARS protests dey likely to take place nationally, for di week of 18 October.

Protests and heightened security presence for major cities like Lagos and Abuja fit take place.

Also, di high profile trial date of one separatist leader also dey scheduled for 21 October for Abuja-di kontri capital.", FCDO warn.

Di Foreign, Commonwealth & Development Office ask dia citizens to take professional security advice before dem go consider to travel to any of di states dem name above.

Earlier in di year United States also update dia travel advisory with warning to dia citizens make dem no waka go 14 states for di kontri.

From Tuesday 20 April, 2020), di US State department don urge citizens to 'Reconsider Travel' to Nigeria.

Why US warn citizen make dem avoid some states for Nigeria?

Di reason dem give na sake of crime, terrorism, civil unrest, kidnapping, and maritime crime.

Dem warn say some areas even get increased risk.

US advise dia citizens not to travel to di following states at all.

  • Borno, Yobe, and Adamawa states sake of terrorism and kidnapping
  • Bauchi, Gombe, Kaduna, Kano, Katsina, and Zamfara states sake of kidnapping
  • Coastal areas of Akwa Ibom, Bayelsa, Cross River, Delta, and Rivers states (with di exception of Port Harcourt) sake of crime, kidnapping, and maritime crime.

Di updated Travel advisory document tok say violent crime - like armed robbery, assault, carjacking, kidnapping, hostage taking, banditry, and rape dey common throughout di kontri

"Kidnappings for ransom dey happun well-well and dem dey most times target dual national citizens wey just come Nigeria for a visit, as well as U.S. citizens wit perceived wealth.

Kidnapping gangs don also stop victims on interstate roads."

Terrorists continue to plot and carrying out attacks for Nigeria, especially for di Northeast.

Terrorists continue to plot and carrying out attacks for Nigeria, especially for di Northeast.

Terrorists fit attack wit little or no warning, dey target shopping centres, malls, markets, hotels, places of worship, restaurants, bars, schools, government installations, transportation hubs, and other places wia crowds gather.

E dey known for terrorist to work wit local gangs to expand dia reach.

E get civil unrest and low-level armed militancy for parts of Southern Nigeria, especially for di Niger Delta region. Armed criminality, including kidnapping and maritime crime, also common well-well for dat region." US State Department tok.

We don update dis tori.