Buea today news: Police officer shoot-kill schoolgirl for Cameroon, spark protest among residents

Wia dis foto come from, Other
Buea, capital for one of de Anglophone crisis region, boil laik volcanic mountain as bullet for gendarme officer hit school pikin, Caroline Ndialle Enongene.
Di five-year-old pikin bin dey inside di vehicle dey go school wen police shoot di car for checkpoint.
Buea resident tell BBC News Pidgin say de incident happen for morning taim, as de mami Lisette Enowgene take pikin dem di go for school.
Gendarmes (paramilitary officer) stop de motor near Molyko Stadium for Buea, de mami stop.
De officer ask documents for motor, Mami Lisette Enognene say e don forget dem for house, den de officer ask for FCFA 500 (1dollar) de mami say e no get, make e go kam.
So as e wan go, de officer open fire, de bullet scatter de pikin e head e die on de spot.
Angry population for de area komot pounce for de officer e head, shoot e wit stones.
De population den carry pikin e die bodi waka go for governor e office.
End of Di one wey oda users dey read well well
Okalia Bilai, Governor for Southwest region tell dem say e regret weti happen, say make population calm down try for mourn de pikin in peace.
Governor say deh go investigate punish all man weh e get hand for de matter.

Wia dis foto come from, Esther Omam
But de angry population komot from governor office, march with de pikin e die bodi for de whole town. Finally deh go bury de pikin for Catholic Burial ground for Buea Town.
Mami Enowgene weh e remain na only wit de pikin e bag and water bottle, di act now laik person say e loss e senses for seka trauma.
Inside video for social media, de mami de ask weda deh don give de pikin de yoghurt weh e bi ask am as she dey unconsolable.
Serge Cyrille Atonfack, Spokesperson for Defense Ministry claim say de driver for de motor bi wan run from control and na de reason weh de gendarme shoot.
"Army regret de accident say deh go investigate, punish de pipo weh de cause de incident."

Wia dis foto come from, Esther Omam
Human Rights lawyer, Agbor Balla craiy say law officer di bi too happy for shoot and say make de army train e pipo for respect human rights.
"Ah di condemn de way army di act wit impunity, but ah di also condemn mob justice. Authorities get for investigate de matter", Balla tok.
Residents for Buea di condemn police harassment, say seven check points dey for inside town. Deh add say wit crisis for Anglophone regions, life for Anglophones no matter.
Social media di scatter wit reactions for pipo weh deh I condemn de action for de gendarme and odas say de woman for respect police control.
Armed group don also react, condemn government forces weh deh no value human life, reduce human being to FCFA 500 (1 dollar)












