Thomas Sankara: Profile of Che Guevara of Africa, Burkina Faso leader dem murder

Thomas Sankara: Profile of Che Guevara of Africa, Thomas Isidore Noel Sankara of Burkina Faso wey dem murder

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Thomas Sankara for one summit in 1983.

Thomas Isidore Noel Sankara of Burkina Faso na one of Africa most celebrated leaders.

Dem kill di Burkinabe former president inside one military coup for October 15, 1987.

Many pipo dey refer to di popular leader as "Africa Che Guevara".

And im dey credited wit laying di foundation for Burkina Faso drive for democratic, social and economic change.

Thomas Sankara: Profile of Che Guevara of Africa, Thomas Isidore Noel Sankara of Burkina Faso wey dem murder

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Dis na bronze statue of Burkina Faso former President Thomas Sankara

Sankara rule for only four years from 1983 to 1987 but leave lasting legacy.

Di one wey dey celebrated no be only for Africa but di world at large.

Di military captain wey turn Pan-Africanist seize power for 1983 by coup wen e be 33 years old.

Thomas Sankara: Profile of Che Guevara of Africa, Thomas Isidore Noel Sankara of Burkina Faso wey dem murder

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Dem kill Thomas Sankara outside di headquarters of im revolutionary council, wia dem place di plaque.

Sankara main vision for di West African kontri dey simple; To remove corruption and end French authority.

To begin di kontri new era e rename di kontri from di French colonial Upper Volta to Burkina Faso.

Bukina Faso mean "Land of Upright Man."

For inside one of Thomas Sankara quotes, e say: "Di enemies of a pipo na those wey keep dem in ignorance."

14 men dey go on trial for di shocking murder of "Africa Che Guevara" 34 years afta im murder.

Dis na seven ogbonge things to sabi about am.

Thomas Sankara: Profile of Che Guevara of Africa, Thomas Isidore Noel Sankara of Burkina Faso wey dem murder

Wia dis foto come from, ALEXANDER JOE/AFP/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Burkina Faso former president Thomas Sankara

Simple lifestyle

Thomas Sankara live simple lifestyle. Wen e take over power, e sell di exotic goment cars and buy cheap ones for imself.

And public office holders. E also ban di use of escorts nad first class tickets.

Sankara reduce im own salary and salary of public servants.

Education

Education na key priority for am. Wen e dey power, literacy rate increase from 13% for 1983 go 73% for 1987.

And Thomas Sankara also oversee massive national vaccination campaign.

Agriculture

Sankara redistribute land from outdated landlords give to poor farmers wey lead to huge increase in wheat production.

United Africa

E call for one united Africa to stand against wetin e call di "neo-colonialism" of institutions like;

International Monetary Fund and di World Bank.

Dem bin quote Sankara to tok say: "Anybody wey dey feed you, go control you"

Thomas Sankara: Profile of Che Guevara of Africa, Thomas Isidore Noel Sankara of Burkina Faso wey dem murder

Wia dis foto come from, IMAGE SOURCE,AFP

Wetin we call dis foto, Thomas Sankara

Compose National Anthem

Di late president write and compose di kontri national anthem.

Tree planting

Sankara plant over 10 million trees to stop desertification of di Sahel plus compulsory physical exercise.

Women empowerment

Number of women for goment increase for di pan-Africanist time as e appoint dem to high governmental position and encourage dem to work.

Sankara ban female genital mutilation and promote contraception. E recruit dem into di military and grant pregnancy leave during education.