You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Buhari in Imo state: President Muhammadu Buhari visit to di state and how dem dey preapare to welcome am
Nigeria President Muhammdu Buhari go visit Imo state South east Nigeria on Thursday 9 September, goment officials tok.
Di president visit to Imo state dey significant sake of sey di state don suffer plenti attack from jaguda pipo in di last seven months.
Dis time, President Buhari dey visit di South eastern state on official visit to commission projects.
"President Buhari go amongst many oda tins do on di spot assessment of di developmental projects as well as commission some of di projects of di Shared Prosperity Government of His Excellency Distinguished Senator Hope Uzodimma," Imo goment tok.
Tori be sey di President go also also hold a town hall meeting wit all category of pipo for eastern Nigeria.
Wetin President Buhari go Commission
President Muhammadu Buhari go commission some major projects of Governor Hope Uzodimma, tok-tok pesin for di govnor tok.
Oguwike Nwachukwu, Chief Press Secretary to di Imo state govnor say di visit na to also show sey federal goment get interest for di development of di state.
According to Nwachuckwu projects wey President Buhari go commission na;
End of Di one wey oda users dey read well well
- Balloon technology-driven underground tunnel with surface drainage - Chukwuka Nwoha
- Naze/ Nekede/Ihiagwa Road
- Egbeada By-Pass - Amakohia
- Newly Built Exco Chambers - inside government house known as Douglas House.
'Ignore fake news'
Ahead of President Muhammadu Buhari visit to Imo state, tori begin fly around say restriction of movement go dey.
Some social media users attribute di restriction of movement to di banned separatist group, Indigenous People of Biafra [Ipob]. Though di group never tok anything.
Na since on di 9th of August Ipob order sit-at-home to protest di continuous detention of dia leader Nnamdi Kanu.
Ahead of di Thursday visit, tori don go round say make Imo pipo continue wit di protest - but di Imo state goment say dat tori na lie.
According to goment, "Dis na to inform di general public say normal movements and work on Thursday 9th September, 2021 go dey as e don come to di notice of di Imo State Government sey fake news dey go around.
Imo state goment never and no go order any holiday or sit-at-home." Di statement tok.
Significance of Buhari visit to Imo state
Di high socio-political group for South eastern Nigeria Ohaneze Ndigbo say di visit of President Muhammdu Buhari to Imo state dey "significant".
Deputy National Leader, Ohanaeze Ndigbo Worldwide (Youth Wing) Onwuasoanya Jones, say, "di president visit to Imo na im first working visit to di State since taking office in 2015.
Na also di first time di state go host a president on working visit since 2009.
Dis visit dey especially significant given di recent communication from di governor of Imo State, His Excellency Distinguished Senator Hope Uzodimma, to di effect say di president dey come to put final seal on some strategic federal government interventions and partnerships wey di Imo State goment don agree wit di federal goment."
President Buhari visit na to mock Imo pipo, PDP
Residents of Imo state no dey happy sey President Muhammadu Buhari dey come di state, Peoples Democratic Party [PDP] tok.
Ogubundu Nwadike, State Publicity Secretary for Imo PDP for statement wey e bring out sey dem no understand di reason for di presidential visit.
"Ordinarily, a presidential visit na grand event. But we note wit regret say di familiar feelings and moods dey absent for di case case of di presidential visit to Imo state.
"Rather dan be expectant and elated, di people are actually wondering wetin di president dey come do for Imo State," di opposition party statement tok.
Security arrangement ahead of President Buahri visit to Imo
Police for Imo state sey em get officers wey dey capable of "suppressing any uprising".
Imo State Commissioner of Police, Hussein Rabiu tell BBC say make pipo expect free-flow of traffic despite di visit of di president.
According to Rabiu "We get men on di ground wey fit manage any security situation. We no need to carry officers from oda states come.
"For di President to visit any state, e mean sey di state don do well be day."