BBNaija nominations today: Pere, Maria, Sammie, Cross, Queen and JMK dey up for eviction

Nominated housemates

Wia dis foto come from, Bigbronaija

Afta week of no eviction, six housemates now dey up for possible eviction on Sunday.

Di housemates wey fit leave di show include Pere, Cross, Queen, Maria, JMK and Sammie.

Head of house Liquorose save Peace wey bin dey nominated come replace her wit Cross wey bin no dey nominated.

Biggie give Maria Pere and JMK strike

Maria, Pere and JMK

Wia dis foto come from, Other

Big Brother housemates Pere, Maria and JMK receive strike afta Biggie find dem guilty of whispering and microphone infringement.

Afta im show di housemates video clip as evidence, Biggie hand di strike to di two former head of house.

For JMK, Biggie say she carry her microphone enter di jacuzzi.

All three housemates bin dey guilty of "microphone infringement, whispering, mumbled talk" dat na why e give dem strike.

Dis one mean say if dem get two more strikes, dem go chop automatic disqualification from di show.

Strike na warning by di organisers of di show to housemates whenever dem go against di laws of di show.

Biggie also add say dem no go fit take part for di head of house games and dem no go get immunity for di next two weeks.

Di punishment also go round to di oda housemates as Biggie say e go punish dem too for constant whispering.

E tell dem say dem go find out dia punishment afta Tuesday morning gym session.

How di housemates vote

Di name Pere and Peace bin full di housemates mouth as na dem get di highest mentions for Monday nomination show.

Queen, JMK and Sammie bin get few montions too alongside Maria and Angel.

Queen - Pere & Peace

Michael - Angel & JMK

Cross - Pere & Sammie

Liquorose - Cross & Peace

Jaypaul - Pere & Maria

Emmanuel - Peace & Pere

Tega - Saga & Peace

Nini - Sammie & JMK

Saskay - Boma & Pere

Boma - JMK & Pere

Saga - Sammie & Queen

Whitemoney - Pere & Peace

Angel - Queen & Michael

Yousef - Jaypaul & Queen

Peace - Queen & Emmanuel

Sammie - Pere & Maria

Jackie B - Pere & Angel

Pere - Michael & Jaypaul

JMK - Pere & Maria

Maria - Queen & Whitemoney

More dey come.