WAEC Timetable: WAEC explain NIN registration demand, breakdown 2021 WASSCE Timetable

West Africa Senior School Certificate Examination WASSCE 2021 new timetable full breakdown dey here.

Di West Africa Examination Council WAEC announce August 16 2021 as di start date for di external examination.

WAEC also don clear air say di use of National Identification Number (NIN) to register for dis year no go dey compulsory.

Head of Public Affairs, Demianus Ojijeogu tell BBC Pidgin say e go dey effective from 2022 and subsequent years.

For di Final International Timetable, di 2021 WASSCE go take place throughout di West Africa sub-region.

Di WASSCE go bein from Monday, 16th August to Friday, 8th October, 2021, according to di time-table breakdown.

However, di examination go end for Nigeria on 30th September, 2021.

Dis mean say e go hold for a period of seven weeks.

Over one point five million candidates' dey expected to sit for di examination.

Di number comprise of 792,620 males (50.36%) and 781,169 females (49.64%).

Di examination body also tok say candidates go dey examined in 76 subjects wey dey made up of 197 papers.

WAEC Timetable: See di full 2021 WASSCE Timetable

Subject paper wey dey available kontri-by-kontri

* Available to candidates in Ghana only

** Available to candidates in Nigeria only

*** Available to candidates in The Gambia and Sierra Leone only

**** Available to candidates in Liberia only

***** Available to candidates in Sierra Leone only