Bole festival 2021: Photos of plantain, fish and sauce wey 'show' for dis year event

Bole Festival na di biggest food festival wey dey happun once in a year for Port Harcourt Rivers-State, South of Nigeria.

Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, Once again e don reach dat time of year wey di popular bole festival dey shelle
Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, Bole Festival dey celebrate one popular street food, special dish of roasted plantain and fish with pepper sauce
Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, Bole Festival na di biggest food festival wey dey happun once in a year for Port Harcourt Rivers-State, South of Nigeria.
Bole festival 2021:
Wetin we call dis foto, Over di years, di festival don grow to become one of di largest food festivals for di region.
Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, Young, old, men and women from all ova di kontri dey show face for di Ogbonge Bole Festival wey dey happun every year for Pitakwa
Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, Di festival start for 2016, wen one group of young minds come togeda to think of ways to show di authentic food and culture of di South-South pipo to di rest of di world
Bole festival 2021:
Wetin we call dis foto, Different food exhibitors na im dey come di festival to showcase di many kind of Bole and fish delicacy
Bole festival 2021:
Wetin we call dis foto, Di Bole Festival dey attract many pipo from all ova di kontri wey appreciate di local food
Bole festival 2021:
Wetin we call dis foto, One of di important thing wey must go with di bole and fish, na di special sauce wey dey mix with tomatoes, red oil and odas
Bole festival 2021:
Wetin we call dis foto, Chicken too no dey left out for dis festival as some pipo like variety to chop with dia bole
Bole festival 2021:
Wetin we call dis foto, Roasted chicken and bole na some pipo favorite
Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, Turkey too get im role to play for dis ogbonge festival
Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, Different kind of fish na im dey show face for di Bole festival
Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, For Pitakwa, na must for Bole dish to get fish with pepper sauce plus also garnish am with vegetable and oda tins
Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, Di Bole festival na di biggest food festival for di southern part of Nigeria wey dey attract many pipo from all ova di kontri
Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, Bole Festival dey celebrate one popular street food, special dish of roasted plantain and fish with pepper sauce
Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, Fish and Bole sera full everywhere
Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, Family, friends and odas dey get time to bond and enjoy dia selve during dis festival
Bole festival 2021
Wetin we call dis foto, Fish no dey tire lovers of Bole