England vs Denmark: Harry Kane goal knock out Christian Eriksen side to take di Three Lions to Euro 2020 finals

Wia dis foto come from, Getty Images
England beat Denmark 2-1 for Wembley stadium for London to set up a final with Italy on Sunday.
Harry Kane goal through penalty for extra time for di 103rd minute put England for di lead and see dem win di game.
Dis na afta Joakim Maehle trip Raheem Sterling inside di box and give England di penalty.
Although Kasper Schmeichel bin save Harry Kane penalty, di ball drop straight into the path of Kane path again for am to slot am into di net.
Before den, Mikkel Damsgaard goal for di 29th minute with free kick afta Luke Shaw grab Andreas Christensen for 25 yards out.
Na di first free kick goal for di tournament.
Denmark goal na di first score against England since March, ending a run of 691 minutes without conceding for di Three Lions.
Na for di 39th minute England restore parity through own goal by Simon Kjaer
End of Di one wey oda users dey read well well
Di 11th own goal of di tournament.
England bin dey look to reach dia first ever men Euros final & first major tournament final since 1966 and dem do am.
Dis na di second semi-final match of Euro 2020, England go play Italy for di Sunday final.
Na just one change England bin make as dem bin hope to make history and reach di European Championship final for di first time.
Arsenal exciting 19-year-old winger Bukayo Saka start ahead of Jadon Sancho, wey dey bench.
Ben White, Ben Chilwell or Dominic Calvert-Lewin no dey stating line-up and dem no dey bench too.
Meanwhile Denmark maintain di same team wey win di quarter-final match against Czech Republic last Saturday.
Dia coach Kasper Hjulmand bin tok afta di match say tiredness na major concern but im go with the same XI again.
Na Simon Kjaer captain di Danes.
England vs Denmark starting line-up
England XI: Pickford, Walker, Stones, Maguire, Shaw, Rice, Phillips, Mount, Saka, Sterling, Kane.
Denmark XI: Schmeichel, Christensen, Kjaer, Vestergaard, Stryger Larsen, Hojbjerg, Delaney, Maehle, Braithwaite, Dolberg, Damsgaard.
See fotos of di fans for Wembley

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images












