You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Prophet TB Joshua burial': Evelyn Joshua lead funeral candlelight procession by Synagogue Church, Emmanuel TV
Prophet Temitope Balogun Joshua widow Evelyn Joshua lead Synagogue Church candlelight procession on Monday.
Monday procession for di Synagogue Church mountain begin di week long funeral rites of di influential Nigerian preacher.
Di candlelight procession witness at least 5000 followers of di late prophet TB Joshua wey die last month.
Pipo from far and wide both black and white na im troop into Lagos Nigeria for di funeral rites.
However, di candlelight procession na private ceremony, according to wetin di Synagogue Church of All Nations tok.
Di only details dem give na say, e go start by 6:30pm on Monday
Di televangelist, and founder of di Synagogue Church of All Nations (SCOAN) die last month at di age of 57.
TB Joshua death occur few days to im 58 birthday.
End of Di one wey oda users dey read well well
Fire outbreak for Synagogue afta candlelight procession
Meanwhile fire outbreak happun for a portion of TB Joshua Synagogue church property for Ikotun Lagos Monday night.
Di fire start about 11:30 pm when pipo just dey come back from di church prayer mountain wia dem do candlelight procession for dia late Prophet TB Joshua.
Tori for ground be say na electrical fault cause di fire.
Fire service pipo neva come di area at about 12:20am.
E take efforts of plenti church members to quench the fire wit buckets of water.
Di fire happun for di restaurant section of church compound