You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How to keep your vagina healthy afta sex
E dey good to always make sure say your vagina dey healthy especially if you dey sexually active.
According to NHS UK, some bacteria and viruses fit enta di vagina during sex.
And dem include di bugs wey dey cause chlamydia, gonorrhoea, genital herpes, genital warts, syphilis and HIV.
You fit protect your vagina against all dis infections by using condom every time you have sex, NHS UK add.
Here na oda ways women fit make dia vagina healthy afta sex;
Use di bathroom after sex
E dey good for you to empty your bladder (piss) immediately afta sex.
Dis na because e go help flush out bad bacteria wey fit don enta your urethra during sex.
If you no use di bathroom to empty your bladder and leave di bad bacteria for dia, e fit lead to urinary tract infections or bladder infection.
End of Di one wey oda users dey read well well
Clean your vagina area gently
Immediately afta kerewa, to keep your vagina clean also dey good too.
Just as to empty your bladder na sure way to reduce di risk of infection.
You need to gently clean di outside part of your vagina (Vulva).
Use warm water to wash comot things like sweat, semen and odas.
If at all you wan use soap for di washing, NHS UK advise say:
Make women use plain, unperfumed soaps to wash di area around di vagina (di vulva) gently.
Remember to clean from Front to Back
As you dey clean di outside part of your vagina (Vulva) make sure say you clean from front to back.
Dis na to avoid make bad bacterial wey dey di rectum no enta di vagina.
If you clean your vulva di wrong way, like from back to front, e fit lead to a build up of bacteria wey fit cause urinary tract infections.
Make you no do douching
Some women dey use a douche to "clean" di vagina.
But according to NHS UK, douching fit disrupt di normal vaginal bacteria so dem no recommend make women use any.
Di vagina normally get lots of bacteria and dem dey dia to protect am.
Douching fit wash out evritin inside di vagina, including all di healthy bacteria.
E no get any evidence wey don show say douching dey protect against STIs or vaginal infections. E fit even fit increase di risk.
No use scented wipes and vaginal deodorants
All dis perfume products fit disrupt di vagina healthy natural balance, NHS UK add.
Washing with water and plain soap na all you need to keep your vagina healthy.
According to sabi pesin, Professor Lamont;
"If nature want di vagina to smell like roses or lavender, e for make di vagina smell like roses or lavender."
You fit also like dis video:
Know your Vagina
Di vagina be elastic, muscular canal wit a soft, flexible lining, according to wey dey provide lubrication and sensation.
Dis be according to WebMD Medical Team.
Di vagina connects di uterus to di outside world.
Di vulva and labia form di entrance, and di cervix of di uterus swell into di vagina, forming di interior end. WebMD add.
Na di vagina dey receive di penis during sexual intercourse.
And also e dey serve as a channel for menstrual flow from di uterus. Experts tok.
During childbirth, di baby dey normally pass through di vagina (birth canal).