Niger state kidnapping: Salihu Tanko Islamic school pupils kidnappers demand 'N100M' to release students one month afta

Wia dis foto come from, Getty Images
Tuesday, 29, June, 2021, make am exactly one month since gunmen kidnap 136 students from Salihu Tanko Islamic school for Tegina town wey dey central Nigeria.
Parents don tell BBC say di kidnappers dey demand N100m to release dia children.
Na last month plenti gunmen attack Tegina town, according to headmaster of di school wey speak to BBC, dem pack 136 students from di school enter bush.
Goment and security forces neva rescue a single student since di incident, three of di teachers wey dem initially kidnap escape and parents say di pain still dey fresh for dia minds.
One of di parents tell BBC say, di gunmen call to make demand but di demand too high.
"Di demand wey dem make na for us to give dem N100 million to release our children, how pesin like me wey all my life I neva see N5m go fit raise dat kain money, e too high, we just dey pray to God to helep us."

Another mother wey get three children out of di kidnapped say e dey pain her say she no know di situation her children dey at di moment but dey pray to God for assistance.
Headmaster of di school Abubakar Alhassan tok say, dem dey continue to negotiate with di gunmen and hopefully di children go return safely.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Inside di 100m dem demand, na only N25miion we don gada so far."
Secretary to Niger state goment (wia Tegina town dey) Ahmed Matane, tell BBC say, goment neva forget about di children and dey try dia best to rescue dem.
Oda major kidnappings wey don happun for northern Nigeria
Kankara school
On 11 December, 2020, gunmen enter goment science secondary school for Kankara town wey dey Katsina state to kidnap over 300 students.
Kagara school
For 27 February, gunmen enter dis secondary school for Niger state where dem carry nearly 50 students go.
Jangebe school
On 2nd of March gunmen also attack Girls secondary school for Jangebe town wey dey Zamfara state wia dem kidnap hundreds of female students.
Greenfield university
For March 2021 gunmen in di middle of di night attack Greenfield university wey dey Kaduna state wia dem kidnap over 30 students go.
College of forestry
On 15th of March, gunmen attack dis college wey no too far from Nigeria Defence Academy for Kaduna wia dem kidnap nearly a 100 students.












