Mallam Bawa: 'I don dey dis newspaper vendor business for 51 years'
Mallam Bawa na newspaper vendor for Zaria, Kaduna wey dey northern Nigeria.
As e clock 51 years for di business e tok about how internet and social media don comot food from im mouth.
“Di day wey Nigeria civil war end for January 1970 na dat day I start work as newspaper vendor so dis year make am 51 years be dat.”
As a newspaper vendor Mallam Bawa say im most memorable day na a day after former head of state Murtala Mohammed die.
“Dat day pipo line up to buy newspapers because everybody wan get news, na only lucky ones get to buy.” E tok.
Producers: Mansur Abubakar, Ufuoma Gift


