Buhari in Borno: Wetin President Muhammadu Buhari do for im visit to di state

President Buhari meet wit sojas for Borno

Wia dis foto come from, BASHIR AHMAD/FACEBOOK

President Muhammadu Buhari don encourage sojas and oda security agents say make dem no give breathing space to terrorists and criminals for di kontri.

Di president tok dis one wen e address di military plus oda security agents wey dey Operation Hadin Kai for Maimalari Cantonment for Borno state, Northeast Nigeria.

Operation Hadin Kai na di counter-insurgency campaign operation inside di state.

Di presido wey do one day official visit go Borno state say na to assess di security situation for di state.

"Make we no give our enemies di opportunity or breathing space to challenge or demoralise our national interests and core values. Make di defence and security agencies dey rest assured of di Federal Government total commitment to win di battle against terror and criminality."

President Buhari meet wit serving and wounded soldiers

Wia dis foto come from, BASHIR AHMAD/FACEBOOK

President Buhari also meet wit serving and wounded soldiers and praise wetin im call dia gallant sacrifice.

E add join say di war against insurgency must end wit peace and reconstruction of all affected areas as e reassure dem say goment don dey repair some of di important weapons for di kontri wey don save di nation foreign exchange and create jobs for di pipo.

During di official visit, di Nigerian leader commission some projects wey include di Vocational Training Institute, health centres and university.

President Buhari commission projects for Borno state

Wia dis foto come from, BORNO STATE GOVERNOR/FACEBOOK

E hail di Borno state govnor, Babagana Zulum say for di two years e don assume di office, e don try well-well.

Di Borno state govnor, Babagana Zulum say im don carry out 556 capital projects since e become govnor of di state two years ago.

Borno na di base for Boko Haram fighters wey dey trouble di kontri for over 10 years now and na di state suffer pass for di whole of Nigeria as far as insecurity dey concern.

Di Borno goment statement hail Buhari for di 10,000 houses initiative wey dem say go go long way to help displaced pipo.

Di 'we no do again' shout wey happen last time

Buhari in Maiduguri

Wia dis foto come from, Twitter/@DeeOneAyekooto

Govnor of di state Babagana Zulum bin don urge Borno pipo to show support and dey orderly during di presido visit.

During im last visit for 12 February, 2020 some pipo bin shout 'Ba mayi' 'Ba mayi' meaning 'we no do' 'we no do' as Buhari dey comot from Shehu of Borno palace.

Na as Buhari bin dey leave Shehu of Borno palace for one area wey dem dey call Yan Nono, some pipo start to shout 'We no do' in Hausa language as Buhari convoy dey pass.

Dat time, di presido go condole Borno pipo after onne serious attack by Boko Haram leave many pipo dead.

Shehu Garba wey be presido Buhari tok-tok pesin bin reply say pesin wey do di video and post am for social media no do justice to Borno pipo wey dey very hospitable and kind.

"I follow for di trip and most important tin na say most of di pipo welcome and thank us for di tins we dey do."

"But wan group say dem no want and I use my ear hear dat one too." Dis na wetin Garba Shehu yan at di time.

For many years, insecurity for Borno state, north east Nigeria, make pipo suffer plenty for di hands of Boko Haram insurgents. Dis na why for 2015, dem give nearly all dia vote to oga Buhari; still re-elect am 2019 wit up to 94% vote.