Twitter ban: Nigeria government suspend micro blogging site operations for 'interference'

Di Federal Government don suspend, indefinitely, di operations of di microblogging and social networking service, Twitter, for Nigeria.

Di Minister of Information and Culture, Alhaji Lai Mohammed, announce di suspension for inside statement for Abuja on Friday, sake of di persistent use of di platform for activities wey dey capable of undermining Nigeria corporate existence.

Dis decision from Nigeria goment dey come days afta Twitter delete one of di tweets Nigeria President, Muhammadu Buhari post on im personal account @MBuhari.

President Buhari bin post thread of tweet on Tuesday wia im address insecurity palava for di kontri.

Im bin issue ogbonge warning to those wey wan destroy di kontri and burn down national asset say "rude shock dey wait dem, very soon..."

Di Minister of Information and Culture, Lai Muhammed announce di suspension for statement on Friday, say di goment issue di suspension sake of how dem dey everly use di platform to cari out activities wey fit undermine di kontri corporate existence.

Di minister also direct di National Broadcasting commission to start di process to begin license all OTT and social media operations for Nigeria.

Why Twitter delete Buhari post?

Di social media company say di tweet violate Twitter Rules.

For inside di post, President Muhammadu Buhari say "Many of those wey dey misbehave today dey too young to dey aware of di destruction and loss of lives wey happun during di Nigerian Civil War.

"Those of us wey dey field for 30 months, wey go through di war, go treat them for di language dem understand."

But wetin be di Twitter rules wey President Buhari go against?

E no dey clear as Twitter direct us to dia rules of engagement and why dem fit comot any post.

Dem tok say "wen we determine say Tweet violate di Twitter Rules, we go ask di violator to remove am before dem go fit Tweet again.

We go send email notification to di violator to identify di Tweet(s) in violation and which policy dem don violate.

Di social media company rule go against any post wey promote violence, harassment and other similar types of behaviour

"You no fit threaten violence against an individual or a group of pipo. We also no go allow di glorification of violence. " dem tok.

Presidency accuse Twitter of Bias

In response to Twitter action presidency say di mission of di social media company for Nigeria dey "suspicious".

Di Minister of Information and Culture, Lai Mohammed ask if Twitter don delete di "violent tweets of di leader of di proscribed group - di Indigenous People of Biafra, Nnamdi Kanu?"

"Di same twitter, dey fund End Sarz protesters" - di protest wey call for an end to police brutality wey happun for Nigeria for October, 2020.

"Wen pipo bin dey burn police stations and dem dey kill police officers for di kontri, For twitter dat na right to protest.

"But wen a similar thing happun on di Capitol for US, e become insurrection." Oga Lai Mohammed tok as im cite di case of attack wey happun for America for January wia Trump supporters attack di US congress building sake of election.

Oga Lai Mohammed add say, "Nobody fit fool us, we get kontri to rule and we go do am to di best of our ability."

He also add say Twitter be "di first to close di account of former US president, Donald Trump.

Buhari no be di first president Twitter go delete im tweet

On Jan. 8, Twitter announce di permanent suspension of former President Donald Trump Twitter account, afta dem delete two tweets im post after di Jan. 6 riot for di U.S. Capitol.

For one, im write: "Di 75,000,000 great American Patriots who vote for me, AMERICA FIRST, and MAKE AMERICA GREAT AGAIN, go have GIANT VOICE into di future. Dem no go dey disrespected or treated unfairly in any way, shape or form!!!"

Twitter say dis tweet "dey interpreted as extra info say President Trump no plan to arrange 'orderly transition'".

For di next tweet, di former president tweet: "To all of una wey dey ask, I no go-go di Inauguration on January 20th."

Twitter say dis one "wey im supporters see be like extra info say di election no dey legit".

Twitter rule say di tweets violate im Glorification of Violence policy.

Afta Twitter permanently cancel di @realDonaldTrump account, Oga Trump tweet from di US president official @Potus account say im go "look at ways of building out im own platform for di future" and fight Twitter.

But dem comot di tweets just as im dey post am.