Nigeria be failed State?: 'Foreign Policy report', Lai Mohammed reply & Nigeria situation

[Nigeria be failed State?]: 'Foreign policy report', Lai Mohammed reply & Nigeria situation

Wia dis foto come from, Getty Images

Federal goment say anyone wey declare "Nigeria as failed state" sake of di security wahala wey e dey face, no get common sense.

Nigeria Minister of Information and Culture, Lai Mohammed yarn dis one as e react to wetin Council on Foreign Affairs for US tok about Nigeria.

Oga Mohammed say Nigeria dey at a point of no return wit all di signs of a failed state.

Na former U.S ambassador to Nigeria, John Campbell and president Emeritus of World Peace Foundation, Robert Rotberg na dem give di report.

But di minister say di fact say Nigeria di face security mata and e dey do everytin to tackle am, no make am a failed state.

E further tok say even though di Council for Foreign Relations na prominent top US policy Think-Tank, dia opinion no reflect dat of di United states.

Oga Muhammed further explain give say di criteria for failed states, Nigeria neva meet am and so dem no go fit term am as failed state.

John Campbel Doomsday Prediction go fail

Di minister say no be di first time wey di diplomat di predict say di kontri go fail or break up.

and dat dem even say di kontri go break up for 2015

But dia doomsday predictions don fail again.

Lai Mohammed

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin be Failed State?

Now agreed one definition of wetin a failed state mean but most dey for kontri wey dem declare as failed state.

But according to Fund For Peace wey di responsible to produce di fragile state index, failed state na kontri wey no fit perform two functions.

One e no fit exercise authority over im territory and pipo and e no fit protect im national boundaries.

Dis one mean say any failed kontri no fit fulfil di administrative and organisation task to provide minimum public service to di pipo and wey di pipo no longer believe dia goment dey legit.

Failing states na product of collapse of di power structure of a country wey suppose support law wey automatically fit trigger internal violence.

John Campbell and Robert Rotberg argue say Nigeria "don become a fully failed state of critical geopolitical concern."

Wetin di for US Ambassador to Nigeria and former president of World Peace Foundation tok dey controversial because dem be pipo wey command serious attention.

Di Primary condition wey dey make pipo refer to a state as failed include:

  • If di kontri lack kontrol over im armed forces, militias
  • Lack control over territory within national borders
  • Failure to provide public services
  • High level corruption for goment
  • High level of refugees wey wan leave di kontri
  • Poor functioning economy
  • Internal collapse of law and order

As situation be so, Nigeria dey show some kain signs of failed state though di political and economic structures have not quite collapsed.

Nigeria be failed State?: 'Foreign Policy report', Lai Mohammed reply & Nigeria situation

Wia dis foto come from, Presidency

Nigeria rising violence up north and oda parts

Security situation don pass be careful for di last few years wit kidnapping for ransom dey grow to different dimension.

Most schools both secondary and tertiary institution don become serious target for Nigeria.

And recently, attacks on both INEC and Police stations don too much.

Na sake of dis presido dey scream say di insecurity mata for Nigeria don become topic across di world.

All di pipo wey want power, whoever dem be, e no clear wetin dem want. Buhari tok.

Di 78-year-old leader say anybody wey wan destroy di system go soon get di shock of dia lives.

"We don give dem enough time." Buhari tok

President Buhari recall say im bin visit all di 36 states of di kontri before di 2019 election.

"And majority of di pipo believe me, and di election prove am."

Di Katsina born president promise to continue leading Nigeria in line wit wetin di 1999 law book [constitution] tok.