Mali Coup: France go suspend joint military operations with Mali afta African Union and Ecowas

Wia dis foto come from, EPA
France say dem gol suspend joint military operations with Malian forces.
And di suspension na until France see clear guarantees say civilians return to power inside di west African kontri.
France Armed Forces Ministry tok for one statement say dia national advisory missions wey benefit Mali go also stop.
Di French operated Barkane counter-terrorism force, Paris get thousands of troops across di Sahel region to fight Islamist armed groups.

Wia dis foto come from, EPA
Last week Mali military bin arrest interim President Bah Ndaw and Prime Minister Moctar Ouane last week and force dem to resign.
Dis one cause katakata afta anoda military coup wey hapun last August to comot di elected president Ibrahim Boubacar Keita.
Experts fear for a stop in transfer of power to civilians alias transition process wey fit lead to democratic elections next year.
African Union suspend Mali afta second coup in nine months
African Union don suspend Mali's membership sake of last week military coup.
End of Di one wey oda users dey read well well
For inside statement, di continental block say dem go punish di west African kontri if Mali no restore civilian-led government.
Dem cut warning for di military say make dem stay away from political process.

Wia dis foto come from, Reuters
Former vice president Assimi Goita, a colonel who bin lead di August coup and last week own na im den declare as presido on Friday.
African Union say make dem do smooth , transparent and fast return to the civilian-led transition.
AU's Peace and Security Council tear dem warning say if smooth transition fail, di Council no go waste time to impose targeted sanctions.
Di African Union bin suspend Mali afta last August coup but bring dem some weeks later.
Dat na afta dem announce heads of di new civilian-led transitional government.
Di Afican Union na ogbonge continental join boid of 54 member kontris inside di whole of Africa.
Why Ecowas suspend Mali, set time for military to hand over
Mali coup wey happun last week don force leaders for di Economic Community of West African State, Ecowas to suspend Mali membership.
Di coup wey new president for now, Colonel Assimi Goïta, bin lead go be di second one for di kontri in di last nine months.
Meanwhile Ecowas don tell Mali to immediately nominate new civilian prime minister.
Dem pass di message to di kontri new Interim military leader wey attend yesterday meeting for Ghana.
Di west Africa regional block also want Colonel Assimi Goita to hold elections by February next year.

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency
Ghana foreign Minister Shirley Ayorkor Botchwey follow tell tori pipo say di joinbodi don hala Mali to pick new civilian prime minister shaperly.
Dem gatz follow 18 month transition plan so dem go fit hold presidential election by February next year, Botchwey tok.
Ghana say e de important make Mali dey stand gidigba as di region dey git terrorist activities.
Colonel Goïta bin seize power afta im order di arrest of transitional president Bah Ndaw and Prime Minister Moctar Ouane on 24th of May.












