You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kebbi boat accident: 100 passengers wey dey travel from Niger state dey 'miss' afta dia boat sink
Plenti pipo still dey miss and fit don die afta di boat wey dem dey travel with sink inside river for Kebbi state, north west Nigeria.
Di passengers wey many na women and children, with a few men bin dey travel from neighbouring Niger State on Wednesday morning wen di boat capsize.
Authorities for Kebbi tell BBC say divers and emergency agencies dey currently work to try to save as many of di passengers.
President Muhammadu Buhari describe di accident as "devastating", as im offer e condolence to di families of di victims.
"We don rescue only 20 pipo alive, four dey confirmed dead while di remaining 156 pipo still dey miss and believe dey say some still dey underwater," na so AFP news agency report say di National Inland Waterways Authority local manager Yusuf Birma tok.
Eyewitnesses say more dan 160 pipo bin dey di boat wen e suddenly break into two for di middle of di river.
Boat accidents along River Niger dey common especially wen di water level rise due to heavy rainfall.
Overcrowding be di reason of some of di boat accidents and accidents wey tree trunks wey dey grow for di river dey cause. Last September, one similar accident for di area kill eight pipo.
End of Di one wey oda users dey read well well