Kobe Bryant Hall of Fame: Michael Jordan speech on Kobe, Vanessa Bryant hall of fame address

Wia dis foto come from, Getty Images
Kobe Bryant don get posthumous induction into di Naismith Memorial Basketball Hall of Fame.
Di five-time NBA champion die, age 41, for one helicopter crash for January 2020.
Bryant meet im death alongside im 13-year-old daughter Gianna and seven odas.
Dem present for di ceremony in Connecticut by NBA great Michael Jordan.
Im widow, Vanessa, accept im induction on im behalf.
For speech, she tok: "You don do am, you don dey for di Hall of Fame now."
Vanessa Bryant add: "You be true champ. You no be just MVP, you be an all-time great.
"I dey so proud of you. I love you forever and always, Kobe Bean Bryant."
End of Di one wey oda users dey read well well
Los Angeles Lakers great Bryant bin retire for 2016: He be di NBA Most Valuable Player for 2008.
Kobe Bryant also be Finals MVP twice and earn 18 All-Star selections.
Di basket ballnlegend bin dey di United States team wey win Olympic gold for 2008 and 2012.
Dem bin delay di 2020 Hall of Fame enshrinement ceremony for one year because of di coronavirus pandemic.
Tim Duncan, one five-time NBA champion wit di San Antonio Spurs dey among di oda inductees.
Even Kevin Garnett, wey help di Boston Celtics win di championship in 2008, also join di Hall of Fame.
Dem bin give di oda inductee 10 minutes for dia acceptance speech.
But dem turn di clock off for Vanessa Bryant, wey her youngest daughters Capri and Bianka later join on stage.
"I know Kobe bin really dey look forward to being here," she tok.
"He no really tok about upcoming awards, but he bin mention dis one a week before he and Gigi pass."
"If my husband bin dey here tonight, he go get a long list of pipo to thank wey help inspire him get him into di Hall of Fame.
"And At di risk of leaving anyone out, I fit only say, 'Thank you."To all those wey help am get here, you know yourself."
Kobe Bryant widow add say: "Nobody fit be like Kobe.
"Kobe na one of a kind. He dey special. He dey humble - off di court - but bigger than life."













