Yoweri Museveni swearing-in 2021: Uganda president begin im sixth term for Kampala

"Yoweri Museveni swearing-in 2021":

Wia dis foto come from, Uganda State House/Twitter

Wetin we call dis foto, Yoweri Museveni take im oath for im sixth term

Uganda swear in President Yoweri Museveni on Thursday for im sixth term.

Di 76-year-old wey enter office for 1986, na one of Africa longest serving leaders.

Museveni win di 14 January election but im main challenger Robert Kyagulanyi, AKA Bobi Wine still dey claim say dem rig di poll.

More than 4,000 pipo, including African leaders witness di swearing-in of President Museveni for Uganda capital, Kampala.

Di Ugandan leader wey take di presidential oath for di seventh time, bin show confidence for di podium today.

"Yoweri Museveni swearing-in 2021":

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Yemi Osinbajo [left inside black agbada] and President Museveni [right in-suit] for Kampala on Wednesday 12 May, 2021.

Many heads of states been dey present for di ceremony - including from Nigeria and Ghana.

Nigeria Vice President Prof. Yemi Osinbajo represent President Muhammadu Buhari for di event.

Di five-year term wey e begin today go mean say im na one of di leaders wey don tey pass for power - after 40 years.

Supporters for di ruling party (NRM) tanda for di road around di area wey di ceremony happen.

"Yoweri Museveni swearing-in 2021":

Wia dis foto come from, Other

Dem go show support di man wey dem like to call M7 as im arrive inside presidential convoy.

Under im leadership, Uganda don progress well for social and economic development.

But some don criticise di leader say e too tey for power, and say e dey make di eye of anybody wey challenge am see wen!

Security bin don increase for di capital, Kampala, for days before im inauguration.

"Yoweri Museveni swearing-in 2021":

Wia dis foto come from, Other

On Monday, di police say dem arrest 40 pipo wey bin dey plan to disrupt di ceremony.

Soldiers surround di house of Robert Kyagulanyi alias Bobi Wine, wey carry second for di 14 January elections.

Yoweri Kaguta Tibuhaburwa Museveni AKA M7 profile

Uganda pipo wey neva reach di age of 35 wey be more than half of di kontri population don only sabi one president;

Yoweri Museveni (for short) bin enta power afta one kasala [armed struggle] wey burst for 1986.

And e don withstand alias do odeshi for all di bad luck wey don befall long serving leaders like am.

"Yoweri Museveni swearing-in 2021":

Wia dis foto come from, PresidentYoweri Museveni

Di 76 year old time as oga at di top of Uganda don dey filled with a long period of peace and development.

But e don use personality cult, compromise of independent institutions and bouncing of opponents to maintain power since 1986.

During di kontri last election, five years ago, im tok say:

"How I go comot banana plantation wen wetin I plant don dey bear fruits?" wen di issue of stepping aside bin come up.