Dare Adeboye: Redeemed Christian Church of God Pastor Enoch Adeboye son die at di age of 42

Pastor Dare Adeboye

Wia dis foto come from, Facebook/RCCG Glory 2 Glory House

Pastor Dare Adeboye, di son of the General Overseer of the Redeemed Christian Church of God Worldwide, Enoch Adeboye don die at di age of 42.

Statement from RCCG on Thursday, 6, May 2021, confam am say e die on di 4th of May, 2021.

Before di official confirmation, Pastor Leke Adeboye, di brother to Pastor Dare Adeboye bin post on Facebook as di tori of im brother death dey make make di rounds for Nigeria media space.

Leke Adeboye wey also be di Special Personal Assistant to di General Overseer of di Redeemed Christian Church of God (RCCG) worldwide post bible quote tok say:

"Di righteous man perish for di hand of evil and no one takes it to heart

Faithful and devout men are taken away, while no one understands

Dat di righteous pesin is taken away to be spared from disaster and evil".

Leke Adeboye post

Wia dis foto come from, Facebook

Leke no categorically confam di death of im brother, but pipo bin enter di comment section to express dia condolence.

Facebook

Wia dis foto come from, Facebook

Facebook

Wia dis foto come from, Facebook

Facebook

Wia dis foto come from, Facebook

Wetin we know about Pastor Dare Adeboye

Pastor Dare na di son and third child of di General Overseer of di Redeemed Christian Church of God, Pastor Enoch Adejare Adeboye.

Im be life coach, visionary leader, motivational speaker and a bridge builder.

Pastor Dare be di Youth provincial pastor for Eket, Akwa Ibom State.

Pastor Dare Adeboye, Pastor-in-Charge of Youth Province 5 dey present award to young pipo wey don show outstanding performance for church

Wia dis foto come from, Facebook/RCCG-YouthProvince5

Wetin we call dis foto, Pastor Dare Adeboye, Pastor-in-Charge of Youth Province 5 dey present award to young pipo wey don show outstanding performance for church

Dem describe am for 2020 as one of di most influential youth pastors for di Redeemed Christian Church of God Worldwide.

Before im death, Dare create mediums for young people to feel empowered and prepare themselves to carry di mantle of di church and di mission and goals of di church

Many pipo dey call am Pastor Dee.

Di young pastor bin serve as di RCCG House of Praise Birmingham Senior Pastor, di RCCG Kaduna 1 Provincial Youth Pastor & RCCG Region 8 Youth Pastor and im also be di North Central Youth Evangelist covering all di YOUTHS, RCF, RCCF, & PSF for di states of Niger, Benue, Kwara, Kogi, Nasarawa, Plateau and FCT.

Pastor Dare Adeboye

Wia dis foto come from, Facebook/RCCG Glory 2 Glory House

Im be di convener of #Dominion2018.

Pastor Dare Adeboye dey survived by im wife and children.