Olisa Odukwe: Police find body of missing British-Nigerian student, footballer after search

Wia dis foto come from, Ubafcofficial
UK Police search for missing university student don find di deadibodi of di man inside harbour water.
Bristol University student Olisa Odukwe 20, comot from im house for Bristol for obodo oyibo on Saturday morning.
Local Police tok say divers bin recover di body from Bristol Harbour and dem no dey suspect say di death na crime.
Authorities don inform Odukwe family.
Di search for di second year Mechanical Engineering student begin on early on Sunday after one woman Daisy Barrows wey say she be Odukwe girlfriend raise alarm.
Ms Barrows inside Instagram post over di weekend: "My boyfriend Olisa Odukwe don miss".
Di most recent social media post by Ms Barrows na black foto, wit di words "rest in peace my love".

Wia dis foto come from, Avon and Somerset Police
Tributes don dey enter for di British-Nigerian wey also be football player.
End of Di one wey oda users dey read well well
University of Bristol Association Men's Football Club (UBAFC), say: "We dey grieve di loss of our dear friend Olisa.
"Olisa na pesin wey everybodi love; na kind, gentle and funny character wey bring smile to di face of anybodi e dey wit".
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Tok-tok pesin for di university say support dey for "all students and staff wey di mata don affect".
"We know say dis news go spoil di belle of many students," di University tok.











