You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria 'unknown gunmen' attacks: Wike, Atiku, Ortom, Sani, Banky W, Nigerians react
Govnor of Rivers State, Nyesom Wike, say di present insecurity and unchallenged killings of citizens across Nigeria na clear bad leadership.
And sake of dat, di govnor say Nigeria don collapse.
Di number one citizen of di oil rich Nigerian state tok dis one on Tuesday for Goment House Port Harcourt.
Wike add say, leaders no dey bold to speak against di bad tins wey dey happen for di land.
Di state govnor add say instead of Nigerian leaders to sincerely pursue solutions, dem dey pretend say everitin dey okay.
"Nigeria don totally collapsed. Look at wetin happen for Nasarawa and Benue States, how dem slaughter pipo on di road.
"See wetin dey happen for Niger State and di APC Governor dia dey cry, say im don dey tok to Federal Goment.
"But nobody dey listen to am and now Boko Haram don come to take over di state, wey be di closest to Abuja."
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Chief Security Officer of Rivers State say im bin don raise alarm of di danger of insecurity wey dey come but dem politicised and dismiss di mata.
But, now na di States under di All Progressives Congress (APC) wey be di worst hit. Govnor Wike add.
Atiku Abubakar warning and advise on Nigeria security crisis
Former vice President, Atiku Abubakar and odas notable Nigerians don begin react to di recent attacks and killings wey dey happun across di kontri.
Atiku bring out statement wey e title; 'Darkness awaits us if we no end di attacks wey dey happun for schools,' and renew im call for goment to declare state of emergency for education sector.
Di Nigeria former Vice president say time don reach for Nigeria as a nation to face di reality say di kontri get emergency to handle and must deal wit am well so dat e no go turn into serious crisis.
E warn say make Nigeria no allow di kidnapping of students from school to become di new normal inside di kontri and advice make dem post armed guards to all schools wey dey di affected states, to guide dia 24 hour.
Atiku say make goment no treat abduction, kidnapping and unlawful detention of pesin with soft hand, instead make dem punish anyone wey dey guilty as way to stop odas from committing dis same crime.
"We must stop treating dis acts of criminality with kid gloves. Enough is enough! Safety of lives and property must dey for our schools..."
Dis na all di more reason why I don dey tok am before say impunity must give way to punitive measures. Wen criminals dey profit from dia bad ways, crime go increase. "
Atiku say once dis criminals know di punishment wey dey waits dem if dey commit crime then di mind to do evil go come weak, and gradually all dis bad-bad crime go stop.
Benue State Govnor Samuel Ortom reaction
Di govnor of Benue State say for di last two weeks, more than 70 pipo don die sake of attacks from different part of di state.
Samuel Ortom call on President to do something to stop di attacks and dat di patience of di pipo don overstretch.
Ortom say di body language of di President show say e be president of Fulani pipo.
E say di president must address Nigerians by himself and make im stop to di send Garba Shehu.
Di govnor finally yarn give say if goat no dey bite but wen dem push am to di wall, e go start to dey bite
Shehu Sani reaction
Former senator wey represent Kaduna Central for di eight national assembly don react too to di recent attacks and killings inside Nigeria.
For one tweet, oga Sani say Governors dey report di incident like tori pipo and dem dey complain like Civil Society Organizations.
"Di Governors dey also report di killings like Journalists and dey lament di killings like CSOs."
Banky W say 'e be like say wey dey abusive relationship'
Nigeria musician and actor Banky Wellington AKA Banky W don also react and describe di kontri current situation as depressing.
Banky W tok say di every day bad news inside di kontri just dey like Nigerians dey for abusive relationship with di kontri wey dem love;
"So much bad news inside Nigeria every day... we don become deaf to di new. If no be murder and kidnapping, na unrest and pipo unfit for office calling di shots.
"E dey like we dey for abusive relationship with di kontri we love. E dey tiring. E dey draining. E dey depressing.
Nigeria security crisis: See round up of attacks across Nigeria in di last 24 hours
Gunmen kill ten near IDP camp for Gana Benue, jaguda pipo burn Court for Ebonyi and other attacks for Nigeria today.
Police say officers don position for Tye Ayagwa village, opposite IDP camp for Abagena along Makurdi-Lafia highway for Benue state.
Tori be say unknown gunmen search from house to house and kill-kill ten pipo - incident wey make police take dis strategic decision, those wey get luck run from di area.
Residents say di gunmen wey be 12 in number bin first wan attack di IDP Camp but becos di pipo dey alert, dem decide to attack di nearby village
Di toktok pesin for Benue state Police, Catherine Anene say security pipo don position for di village wey di killing happen and di command dey meet leaders of Fulani pipo for di state.
Bandits kill DPO and eight officers for Kebbi
Nigerian Police don confam di death of DPO and eight oda officers for Kebbi state wey dey northern Nigeria.
Tok tok pesin for Kebbi Police Command Nafiu Abubakar confam di tori to BBC.
Abubakar tok say di late DPO and im officers respond to distress call from one village for Sakaba Local Government Area of the state wia exchange of fire between dem and gunmen lead to dia death.
Mob attack police station for Sokoto
Mob kill suspect, burn divisional police headquarters and vehicles for Sokoto state.
Police enter Kware area come arrest hoodlums wey enter di town to rob one man.
But later angry residents insist say police must hand di six thieves over for jungle justice.
As police no gree na so fight start wey lead to death of one of di suspects and destruction of plenti properties.
Hoodlums attack Federal high court for Ebonyi state
Some jaguda pipo don attack di Federal High Court wey dey for Abakaliki Ebonyi state, South eastern Nigeria.
Dis dey happen as security agencies dey battle unknown gunmen wey dey worry South eastern Nigeria with different attacks.
Tok-tok person for Ebonyi state Police command Obianuju Odah confam di attack on di federal high court to BBC where she tok say di attack happen Tuesday morning.
"Wetin we hear be say di hoodlums throw wetin be like dynamite inside the court. Dem no consider weda pipo dey inside di court or not.
"On a normal day Police dey provide security for court but our personnel dem no dey dia when di attack happen. So Police no lose anybody for di attack.
"We observe blood stains for di walls of di court but we never fit give account weda casualties dey. Commissioner of Police don order investigation into wetin happen", she tok.
Normalcy return to Owerri after gun battle for Ama-Hausa
Normalcy don return to Ama-Hausa for Douglas road Owerri, di Imo state capital after security pipo engage some gunmen for shoot out for di area on Monday night.
Tori be say di gunmen bin wan attack Ama-Hausa wey be settlement for Northern traders but security operatives including army and police repel di attack - nobody die during the shootout.
Some boys also carry anoda attack enter mbano where dem kill five officers and den burn Okigwe south area command.
As part of effort to end insecurity, di south-east governors wan start to recruit pipo into Ebubeagu and dem don direct di the composition of advisory board for di regional security outfit.
IDPs for Niger State dey return to dia villages
Some of di Internally Displaced Persons (IDPs) were rush enter Minna, di Niger state capital after dem attack dia don begin go back dia villages.
Video see where buses dey carry di IDPs dem go back dia various villages while odas say dem go remain for di camp until security improve.
One youth leader wey lead some of di IDPs to di camp say di security situation for Munya local government area of di state dey weigh dem down.
The youth leader say Nigeri state govnor don promise to secure dia villages for dem.
One Fatimah Garba wey also tok to BBC tok say she no dey go back her village.
"I dey go back my papa house from dis IDP camp until my husband village dey peaceful. I don tire for di tension wey bandits dey give us. "
She add say "we don pay ransom sotay di last one wey we pay na N1.5million before dem release four of our pipo wey dem kidnap.
"Make goment come out come help us to stop dis tin." according to her.