Idriss Déby Itno funeral pictures: Chad President burial

Wia dis foto come from, AFP
Idriss Déby Itno funeral don begin shele for N'Djamena di capital of Chad.
Di burial of Chad President Idey hold even on top rebel groups threat for foreign leaders not to attend.
Oga Déby bin die on Tuesday 20th April, 2021 afta dem shoot am for fromt of battle ground with rebels.
E die at di age of 68.
See Chad President Idriss Déby Itno burial fotos

Wia dis foto come from, AFP
Mali and Guinea heads of state don already land di west central African kontri ahead of di funeral.

Wia dis foto come from, Reuters
French President Emmanuel Macron go also travel go Ndjamena, even though rebels for ground don tear warning say make foreign leaders no show as gbege fit happun.
After di military honours and di different-different speeches, dem go do prayer for di Grand Mosque for N'Djamena.

Wia dis foto come from, EPA
Idriss Deby enta power for 1990 afta im overthrow Chadian President Hissene Habre - with the help of di French secret service.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Deby na very clever tactician, na im be President Habre chief-of-staff, wey lead series of victories over rebel forces in di 1980s.
Afta six years in office, im set up Chad first multi-party political system and win elections dat year.

Wia dis foto come from, EPA
Tori be say im also get have health problems wey im dey travel go Paris for treatment for im liver.
Deby gain a fifth term in elections for April 2016.

Wia dis foto come from, Getty Images
In 2018, parliament pass one controversial change to di constitution wey increase President Deby powers even though opposition bin warn say e go undermine democracy.













