Idriss Deby Itno son General Mahamat Kaka Déby go be Chad new leader

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Chadian army don confam General Mahamat Idriss Deby Itno, son of slain president Idriss Deby Itno, go replace am as head of military council
Di appointment of di four-star-general dey come afta Chad President Idriss Deby Itno die of injuries wey e suffer for frontline attack earlier on Tuesday.
General Mahamat Kaka go take over as di interim president of di kontri and im go lead di nation for at least 18 months, na so army spokesman, General Azem Bermandoa Agouna, announce for state radio.
Before dis announcement, General Kaka be di Chairman of di Transitional Military Council of Chad.
Im bin formerly serve as di second in command of di Armed Forces for di Chadian Intervention for Northern Mali (FATIM).
One political analyst, Dr Evariste Ngarlem Toldé tell BBC say di naming of Idriss Déby' son as leader violate Chad constitution wey tok say di speaker of parliament suppose take over in di event of presidential vacancy.
E add say di constitution also expect di speaker to organise elections wey Mahamat no go even be candidate.
Wetin go happun next for Chad?
Idriss Déby na huge figure for Chad - im stay three decades for power.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di most significant military actor for di region, deploying forces to assist Nigeria for di campaign against Boko Haram, im na one major player for di G5 Sahel, wit troops for Mali and Niger, and e be big influence over events for di Central African Republic.
Internally, di regime still appear to be in command, now wey im son dey head di goment.
But di longer term outlook no dey certain. Dem just re-elect oga Déby for contest wey im opponents say e no dey democratic - e no dey clear whether im successor go fit sustain dis authoritarian system.
Internal politics and rivalries within Oga Déby own Zaghawa clan na part of di consideration.
Tori be say Oga Déby wound wen e dey fight rebels for Kanem region, just 400km (248 miles) from di capital, N'Djaména
Before now rebel activity dey happun for di north, for di Sahara and close to di border wit Libya.
But dis fight suggest say instability don move much further south.
E get some deep underlying political, societal and development pressures for Chad wey oga Déby forceful rule don contain but certainly not resolved.
Plenti tins go depend on how im son new military regime manage to prepare di next political stage and whether e go seek to develop dialogue and consensus about di way forward or whether e go try to sustain di type of constitutional strongman regime wey oga Déby don build.










