Olu of Warri: Delta Govnor Okowa endorse Tsola Emiko as new Itsekiri King

Wia dis foto come from, Twitter
Olu of Warri, Tsola Emiko don get di official goment endorsement from Delta State govnor Ifeanyi Okowa as di new Itsekiri King
Okowa give dis message to di Advisory Council of di Olu of Warri for meeting for Goment House, Asaba.
Di Delta State govnor tok say di new Olu get di support of di goment of Delta State.
Warri Traditional Council Of Chiefs bin announce oga Emiko as di Olu-designate on Monday 5 April, 2021.
Dis na di same day wey dem officially announce di death of His Majesty, Ogiame Ikenwoli, di former Olu Of Warri and declare three months mourning before di coronation of di new Olu.
Dis one mean say all adults for di Itsekiri Kingdom go wia dia clothes upside down.
Govnor Okowa for di meeting tok sorry give di Itsekiri pipo ova di loss of di Olu of Warri, Ogiame Ikenwoli wey im call "a king wey believe in peace".
Di process to pick Olu for Warri include say afta dem don select am, dem go present di Olu give di Delta State Govnor wey go come present am with staff of office.
End of Di one wey oda users dey read well well
Who be Tsola Emiko?
Dem born Prince Utieyinoritsetsola Emiko on 2nd April 1984 to Ogiame Atuwatse II the Olu of Warri, before e become king and Olori Gladys Durorike Emiko, in Warri, Nigeria.
Prince Omatsola get im basic education from NNPC Primary school for Warri and for im secondary education, e go Adesoye College, Offa, Kwara from 1995 to 2001.
Im attend di Case Western Reserve University, Cleveland, Ohio, USA wia e collect im Bachelors of Arts degree, e major in International Studies & Political Science, while minoring in History & Economics from 2002 to 2006.
Di prince marry Ivie Okunbo, daughter of billionaire Capt. Idahosa Okunbor for one ogbonge wedding ceremony for 2014.
Di marriage dey blessed with children.














