Olu of Warri dies?: Death tori of Itsekiri King, Ikenwoli Godfrey Emiko - Wetin we know

Wia dis foto come from, Other
Olu of Warri, His Royal Highness Ogiame Ikenwoli Godfrey Emiko na di 20th King of di Itsekiri pipo of Delta State Nigeria.
King Ikenwoli Godfrey Emiko na 19 March, 1955 dem born am to Olu Erejuwa II (1951-1986) and Olori Eyinagboluwade.
Emiko na di reigning Ogiame - wey mean king - of Warri wey be di main home of Itsekiri pipo for di Niger Delta region of Nigeria.

Wia dis foto come from, Warri Kinddom
Dem crown Ogiame Ikenwoli on di 12th of December 2015[2] for Ode-Itsekiri, wey be di ancestral home of di Itsekiri pipo.
Olu of Warri Ikenwoli Godfrey Emiko dey married to Olori Mary Emiko and dem get three children.

Wia dis foto come from, Other
[Olu of Warri dead?]
Local media since Monday 21 December dey report say Olu of Warri die from Covid-19 complications (tori wey BBC Pidgin never confam).
According to di tori, di monarch die for Lily Hospital, Warri but details of im death remain sketchy.

Wia dis foto come from, Lagos State Government
BBC Pidgin gather tori say na only official announcement by di Ologbosere of Warri, Chief Emami Ayiri,wey be di traditional Prime Minister of di town, get power to break di news of di king death.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Olu of Warri dey rule over Itsekiri land, parts of di southern Delta state south of Nigeria, wey dey full of creeks and swamps.

Wia dis foto come from, Warri Kingdom
Wetin we know about di Olu of Warri "death"
One source from Ejo Royal family for Itsekiri land wey no go like make we mention im name explain to BBC News Pidgin say if di tori of di death of Olu of Warri dey true, na only di head of di chief -di traditional prime minister- fit announce am.
E say di process na say di Ologbosere go call a general meeting of di Itshekiri pipo wia im go announce whether di king don go join im ancestors .
"Till then anything wey you hear na rumor", he tok.

Wia dis foto come from, Warri Kingdom
Di royal source also note say for di Itshekiri tradition, di king no dey die.
So e dey wrong say to say "Di Olu of Warri don die".
"Wen dem don go through di process of putting things in order, dem go come later announce to all di Itshekiris around di world, di passing of di King." He add.

Wia dis foto come from, Presidency
[Warri Kingdom]
Di Kingdom of Warri [Warri Kingdom] or Iwere Kingdom (1480-1848) bin dey di colonial Nigerian traditional states.
Di Olu or Ogiame (King) of Warri now dey only rules di Itsekiri pipo wey dey in di town of Warri for Delta State of Nigeria as a traditional leader.
According to Bini and Itsekiri histories, Olu Ginuwa, a prince of Benin Kingdom na im discover di Warri kingdom about 1480.
For 1997, Nigeria Federal Government under General Sani Abacha create Warri South-West Local Government Council, with headquarters for Ogidigben wey be Itsekiri community in Warri.











