Suez Canal free: Ever Given giant ship don free from blocking freight transport from Red Sea into Mediterranean sea
Di huge container ship wey hook across Egypt Suez Canal for almost a week don dey free.
Di Ever Given na 400m-long (1,300ft) container ship wey don dey hook for di canal since Tuesday free from di shore and refloat early on Monday, officials tok.
Di course alias direction of di giant ship don dey corrected by 80%, according to di Suez Canal Authority.
Di agency wey dey manage di canal add say further efforts to move di ship go resume later on Monday.
Maritime services company Inchcape also report say di ship don dey free.
Di reports say di ship don dey free raise hope say sea traffic along di canal fit start again within hours, e go pave way for an estimated $9.6bn (£7bn) of goods wey don dey trapped each day.

Tori be say Suez Canal Authority on Sunday release video wey show crews ontinue to work to free di "Ever Given" ship, including di removal of canal coverings and dredging around di ship bow.
Video wey dem post for social media on Monday appear to show di stern of di Ever Given dey swing toward di canal bank, opening space inside channel.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di agency say dredging and drilling operation na to bring di canal to a depth of 18 metres in order to help float di giant container ship.

Wia dis foto come from, EPA

Refloating di ship take long effort involving tugboats and dredgers.
Head of a company involved in di rescue efforts call for carefulness, warning say completing di operation no go be "moi-moi".
Suez Canal, wey pass through Egypt, na one of di busiest trade routes.
Di grounding of di Ever Given - part of di Evergreen fleet - mean say oda ships gatz to reroute around Africa.

Wia dis foto come from, EPA

Wia dis foto come from, Maxar Technologies
Attempts to refloat di giant ship
Canal officials say dem make small progress and dem dey hope say by Sunday evening dem fit float di ship.
More than 300 ships tanda inside di water as no way for dem to pass.
After several days of failing to free di vessel, on Sunday canal officials begn prepare to remove some of roughly 20,000 containers on board di ship in order to lighten di load.
Experts earlier tell di BBC say such an operation go involve bringing in specialist equipment, including a crane wey go need to stretch more than 60m (200ft) high, and say e go take weeks.

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Getty Images
Some vessels safe don find anoda route around Africa.
On Saturday dem dredge about 20,000 tonnes of sand, and 14 tugboats pull and push di Ever Given in order to try to move am.
Although strong tides and winds complicate efforts to free di ship, di tugboats managed to move am about 30 degrees in two directions.
Footage wey dem post for Twitter show as di tugboats dey horn to celebrate dia small victory.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Why di Suez Canal dey important?
About 12% of global trade dey passes through di 193km (120-mile) canal, wey dey connect di Mediterranean Sea to di Red Sea and e dey provide di shortest sea link between Asia and Europe.
An alternative route, dey around di Cape of Good Hope for di southern tip of Africa, dat one fit take two weeks longer.
According to data from Lloyd's List, di blockage dey hold up to an estimated $9.6bn (£7bn) of goods each day - or $400m an hour.
Oga Rabie estimate say Egypt dey losing up to $14m in revenue each day wey di canal dey closed.
Im say Egypt dey grateful to US, China and di United Arab Emirates for offers to help.
Data from shipping expert Lloyd List put di value of di canal westbound traffic for roughly $5.1bn a day, and eastbound daily traffic at around $4.5bn.

Despite efforts to free di ship, expert's tok say e go take weeks to remove am.
Two major shipping companies, Maersk and Hapag-Lloyd, say dem dey find oda options to avoid Suez Canal.
Egypt Suez Canal Authority (SCA) say dem dey do everything for dia power to refloat di ship wit tug boats, dredgers and heavy earth-moving equipment.
Ship blocking Suez Canal fotos

Wia dis foto come from, EPA

Wia dis foto come from, EPA

Wia dis foto come from, EPA

Wia dis foto come from, EPA

Wia dis foto come from, EPA

Wia dis foto come from, EPA

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Suez Canal na artificial sea-level waterway inside Egypt, connecting di Mediterranean Sea to di Red Sea through di Isthmus of Suez na di canal dey divide Africa and Asia.
Dem construct am between 1859 and 1869 and officially open di canal on 17 November 1869. Na Suez Canal Company wey Ferdinand de Lesseps establish in1858 construct am.
All pictures dey subject to copyright.














