Europa League draw live: Man Utd v AC Milan, Rangers v Prague, Arsenal v Olympiakos, Tottenham v Zagreb

Manchester United go play seven-time Champions League winners AC Milan for di last 16 of di Europa League.

AC Milan, wey dey second for Serie A, never win di competition while United only triumph happun for 2017.

Arsenal, wey reach 2019 finals, go face Greek side Olympiakos, wey knock dem out for di last-32 stage last year.

Tottenham go play Croatia side Dinamo Zagreb while Rangers go battle Czech side Slavia Prague, wey defeat Leicester City on Thursday.

Di eight last-16 ties go take place on 11 and 18 March.

Former Manchester United striker Zlatan Ibrahimovic dey set to return to Old Trafford for di second leg, wen di two sides go meet for di 12th time for European competition - all di time wey dem don meet before now, na for di Champions League.

Tottenham opponents Dinamo Zagreb, wey go host di first leg, don lose nine of their last 10 matches against English clubs for European competition, dem win di other game 2-1 against Arsenal for Champions League group stage for 2015.

Europa League last-16 draw

Ajax v BSC Young Boys

Dynamo Kiev v Villarreal

AS Roma v Shakhtar Donetsk

Olympiakos v Arsenal

Dinamo Zagreb v Tottenham

Manchester United v AC Milan

Slavia Prague v Rangers

Granada v Molde

Teams wey dey drawn first go play second leg for dia home ground.