Zamfara secondary school girls Jangebe kidnapping: Gunmen abduct 317 students from Government Secondary School

Zamfara state police command don confirm di abduction of 317 students wey gunmen kidnap from dia boarding secondary school early morning today for di town of Jangebe, for Zamfara state, north west, Nigeria.
For inside statement, di police say dem and di military don begin joint search to rescue di students wey di gunmen kidnap at about 0100 hours.
Dis tori dey come afta gunmen kidnap boys from Kangara school for Niger state on February 17, 2021.

How di attack happun?
According to tori, na around 1:00am in di night di gunmen attack di school.
Zamfara state Commissioner of security and home affairs Abubakar Dauran tell di News Agency of Nigeria (NAN) say di gunmen go fit reach like 100.
Kabiru Sani wey be vice president of voice of di masses group for Zamfara state tell BBC say dem kidnap three of im nieces and im and oda pipo don enter bush to go find dia children.
Anoda man tell BBC say dem kidnap im daughter and two of im nieces and e yan say di gunmen numbering hundreds enter di school after midnight, dem first handle di gatemen first before dem pack di students go.

'54 students left behind'
According to reports from di school, di gunmen leave 54 students behind.
End of Di one wey oda users dey read well well
Parents and guardians of di students wey escape di attack don come pick dem from di school.

Meanwhile reactions don dey pour in afta dis latest incident.
Di United Nations International Children Emergency Fund, (UNICEF) say "di targeted attack on students, teachers academics and education personnel dey unacceptable."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Dis kidnapping dey come just over one week wey bandits storm Government College School for Niger State and abduct school boys dia.
Dem never still free di boys.
Timeline of high profile students abductions inside Nigeria before Jangebe
Kagara (2021) - 27 students, 15 others
Kankara (2020) - 344 students
Chibok (2014) - 276
Dapchi (2018) - 113
- 344 Kankara students released
- 112 Chibok girls dey miss
- 107 Dapchi students released. 6 killed. Leah Sharibu dey miss




![[Niger State] GCS Kagara school kidnap update:](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/1405F/production/_116151028_kankaraadbductionrescue.jpg.webp)






