You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Sunday Igboho storms Ogun State: 'Yoruba no hate Fulani na di bad ones we no like' - Oba Akintunde Akinyemi
Di Eselu of Iselu Kingdom for Yewa North Local Government Area of Ogun State South West Nigeria, Oba Akintunde Akinyemi say "Yoruba pipo no hate Fulani but na di bad ones dem no like".
Di traditional ruler for one of di communities for Ogun state where herdsmen allegedly dey disturb well-well also declare support for Sunday Adeyemo aka Sunday Igboho - di Yoruba activist wey give di herdsmen ultimatum to leave di south-west of Nigeria.
Oba Akintunder follow BBC Pidgin tok for interview on Tuesday.
Im declaration of support dey come afta Sunday Igboho pay di kabiyesi visit to im palace on Monday afta e land Ogun state wit im campaign to drive Fulani herdsmen comot from di South West.
Di traditional say e no dey happy wit how herdsmen allegedly destroy pipo farmlands for di communities, rape women, kill pipo, turn many children to orphans and become threat for di communities.
Dis na part of di reasons wey im say e stand wit Sunday Igboho, Gani Adams, Femi Falana, liberation and oda good pipo of Yoruba land wey want liberation.
Im say all im want na make everybody obey di law as nobody dey above di law, whether na Fulani, Igbo or Yoruba. and make security agencies take over full responsibility of security for di land.
“If police don ready to take over dia primary duty, leave dem make dem do dia work, we don already send signals, if we dey abide by di laws, make Fulani pipo too abide by di law.”
End of Di one wey oda users dey read well well
On Monday some unknown pipo bin allegedly burn down houses and markets wey belong to di herdsmen for Eggua community afta di Yoruba activist Sunday Igboho carry im campaign to pursue di herdsmen from Yoruba land enta Ogun State.
Di Kabiyesi say e pray and preach peace for Igboho wen e visit am.
But for wetin happun for Eggua community, im no know as im no be di di traditional ruler for dat community.
Oba Akintunde recount all di challenges dem don get wit herdsmen since e climb di throne 16 years ago say dem don become slaves for dia land as herdsmen don allegedly become threats for dia land, destroy dia farm lands, rape dia women, render children orphans, injure many pipo and dey act like say dem dey above di law.
Im want make goment dey sincere, compensate im pipo wey don loss dia means of livelihood, train children wey no fit go school again sake of dia parents wey herdsmen don kill or injure, and do di right thing as nobody dey above di law.
Meanwhile di Ogun State Commissioner of Police Edward Awolowo Ajogun don meet wit di traditional leader for Eggua and di Seriki Fulani of di community sake of di incident wey happun on Monday.