You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Silhouette Challenge: Mercy Eke, Venita, Funke Akindele, Don Jazzy post video of di social media trend
Silhouette Challenge na di latest and di biggest social media trend wey dey reign now for many young pipo.
Dis challenge dey see girls, in particular, show dia body shape through silhouette image with di help of Snapchat and TikTok latest filter.
Di video usually dey dey dark wit reddish background so e dey difficult to see pesin body part.
Also anoda tin about dis challenge na di song wey dem dey use, American-Canadian singer Paul Anka hit single "Put Your Head on My Shoulder", na im dey dey as background music.
Just like di #BussItChallenge, some celebrities for Nigeria don begin jump on di #SilhouetteChallenge.
See some Nigerian celebs wey don post about di SilhouetteChallenge.
Mercy Eke winner of Big Brother Naija pepper dem season post video wia she do di challenge
Vee anoda Big Brother Naija house mate join di trend
Funke Akindele AKA Jenifa
Don Jazzy
Venita Big Brother
But wetin be di Silhouette Challenge sef?
Well di Silhouette Challenge na video wey pipo dey pose sexy for door side or frame before dem go sharpaly turn to black silhouette for red background.
Di hashtag #silhouettechallenge don already get pass 100 million views but nobodi know who first start di trend.
End of Di one wey oda users dey read well well
How to use di Vin Rouge filter?
You dey tink how to get di red background? Well, you gats go Snapchat and find di Vin Rouge filter for dia.
Vin Rouge filter na camera effect wey go turn your whole screen red, and leave you body to black like shadow. E go come be like say your room dey use red studio light.
For di challenge, you go first do one video of yourself as you dey stand for doorway wey go be di same body position you go start for di second video.
Wetin dey make am sweet na smooth transition.