School resumption in Nigeria latest: SSANU, NASU to begin indefinite strike nationwide

School resumption in Nigeria latest: SSANU, NASU nationwide protest begin today
Wetin we call dis foto, Dis protest ontop goment failure to honour one agreement wit di unions dey come just barely three weeks afta ASUU di umbrella union of Nigerian university lecturers suspend nine-month strike ontop di same agreement.

Joinbodi of non academic staff of Nigeria universities NASU and SSANU say dem don give goment 14 days ultimatum starting from January 22 to meet dia demand or dem go proceed on indefinite strike all over di

kontri.For statement on Friday leadership of di two unions say dem go begin indefinite strike on 5th February 2021 if goment no respond.

Dem say after due consultation wit dia members, over 80 percent of members of di two bodies vote for dem to proceed on strike.

Di non academic workers bin do three days warning protest last week to demand make goment stop to dey use di IPPIS payment system to pay dia salaries and to pay dem dia earned arrears.

Oda tins wey dey dia demand list include non-payment of arrears of minimum wage, non-payment of retirement benefits outgone members, neglect and poor funding of both state and federal universities etc.

Dis situation fit cause anoda wahala for Nigeria university students as dem bin done spend about one year for house sake of di strike wey dia academic staff bin do

NASU, SSANU Protest for Three Days

Non-Academic Staff Union of Educational and Associated Institutions [NASU] and Senior Staff Association of Nigerian Universities [SSANU] don begin dia 3-day protest.

Di non academic staff dey para on top di sharing formula of di 40 billion earned allowance moni wey goment promise to pay dem and ASUU togeda. While ASUU dey collect 75 percent of di moni, dia share na 25 percent.

Di Joint Action Committee (JAC) of di two unions explain give say di protest na against di sharing formula of N40 billion earned allowances wey goment recently approve and non-implementation of di agreement wey dem also reach wit goment for 2009.

Dis protest ontop goment failure to honour one agreement wit di unions dey come just barely three weeks afta ASUU, di umbrella union of Nigerian university lecturers, suspend nine-month strike ontop di same agreement for December 2020.

SSANU member carry placard
Wetin we call dis foto, SSANU member carry placard

Di protest dey happun a day afta Nigeria Minister of Education, Adamu Adamu say di goment dey see how to review alias pospone di 18 January , 2021 resumption date.

Di protest go last for three days from today to Thursday 14 Janyary 2021 and e go happun for each branch. Dis one mean say dem fit no enta street go demonstrate.

Di minister say goment decision na sake of di COVID-19 case wey di rise nyafu-nyafu for di kontri.

Di problem here be say all di hope wey university student get say dem go las las go back to school afta di nine months strike by ASUU don dabaru sake of dis new development dem.

SSANU protest Lagos unilag
Wetin we call dis foto, SSANU protestfor University of Lagos

Wetin di Non Academic Staff [NASU, SANU] dey Demand

Di NON Academic Staff bin sign Memorandum of Understanding wit di federal goment for 20th October, 2020 and di issues wey dem capture na

•Inconsistency on top IPPIS payment

•Non -payment of Earned Allowances

•Non -payment of areas of minimum wage

•Delay to renegotiate FGN/NASU and SSANU 2009 agreement

•Non -payment of retirement benefit for outgone members

•Poor funding of state universities

•Non-constitution of visitation panel

SSANU members for Kogi chapter

Wia dis foto come from, SSANU Kogi

Wetin we call dis foto, SSANU members for Kogi chapter dey protest dia allowance

Di union say since dis agreement, goment don fail to address any of dis issue but goment never reply dis accuse.

Di koko be say during di ASSU strike, goment agree to pay 40 billion earned allowance to all di unions for university but since that time till now schools never re-open.

But during di negotiation, ASUU negotiate to cari di lion share wey be like 75 percent of di moni and den, dem go give di rest union, 25 percent.

So wen di oda unions hear di decision, dia mind spoil inside and dem come vow say dem self no go gree until goment shake bodi and increase dia moni.

Di union say di process wey dem take come up wit di sharing formula no dey scientific.