Travel ban: UK don place travel ban on 14 African kontris

UK ban travellers from 11 kontris entry to di kontri

Wia dis foto come from, Getty Images

From 9 January, 2021 all international passengers go need test negative for Covid-19 before dem fit travel enta di United Kingdom.

Pipo wey dey arrive by plane, train or boat, including UK nationals, suppose don do test 72 hours before dem comot di kontri dem dey.

Di goment say di new controls na to protect di kontri against di new strains of coronavirus wey show for kontris like South Africa.

Dis na as di UK don ban travellers from fourteen African kontris from entering di kontri.

UK Transport Secretary Grant Shapps wey give di travelling update say travellers no go fit travel if dem no get negative test result.

Even wit a negative test, pipo wey dey come from kontris wey no dey di travel corridor list must still dey quarantine.

Oga Shapps say goment don make compulsory testing now because of di new variant of di virus wey dey spread for South Africa, which im say dey make scientists worry well-well.

African kontris inside UK travel ban list

Di UK for dia website list di 11 kontris and di ban go begin from Saturday, 9th January.

Most of di kontris wey make di list all be for southern Africa or neighbouring kontris around South Africa.

African travellers

Wia dis foto come from, Getty Images

  • Namibia
  • Zimbabwe
  • Eswatini
  • Zambia
  • Botswana
  • Malawi
  • Lesotho
  • Mozambique
  • Angola
  • Seychelles
  • Mauritius
  • Cape Verde
  • Tanzania
  • Democratic Republic of Congo

Dis restriction go dey in place for at least two weeks.

Di rule no apply to British and Irish nationals, long-term visa holders or permanent residents - but dem go need self-isolate, because of di coronavirus variant dem discover for South Africa, wey fit dey more contagious.