You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
NIN registration: NIMC staff suspend strike action to continue NIN registration
Workers of di National Identity Management Commission don suspend di strike action wey dem start on Thursday over poor allowances and fear of exposure to Covid-19 spread for di agency.
Di workers union say dem decide to put di strike on hold after dem hold meeting with di Federal Government.
Dem say for di meeting, di federal goment agree to look into di demands of di employees.
Many Nigerians bin dey unable to register for di ongoing National Identity Number (NIN) registration because workers of di National Identity Management Commission dbin down tools.
People wey turn up to register for Lagos and Abuja for wetin BBC PIdgin carry eye see on Thursday bin just dey stranded for di NIMC offices.
Some of di workers wey tok to BBC Pidgin explain say di reason dem stop work na sake of poor pay.
Lucky Asekhohia wey be di chairman of di employees union, tell BBC Pidgin say dem dey attend to thousands of Nigerians wit out beta protective equipment.
Di NIMC employees strike action don stop di ongoing NIN registration nationwide as dem dey demand for living wage plus ask management to provide dem wit PPE as dem dey at risk of covid 19.
End of Di one wey oda users dey read well well