You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Bola Ahmed Tinubu: Tinubu don do Coronavirus test for 15 times - Aide
Di tori dat say top Nigeria politician Bola Tinubu don catch covid-19 and dem send am go France no be true.
For statement Tinubu tok tok pesin Tunde Rahman say di tori na lie from di pit of hell.
"Asiwaju dey veri ok and e dey fine not sick. E no get covid-19" na so Mr Tunde tok.
E add say "we don do covid-19 test on him 15 times wey im travel and feel mix up with pipo, dey vulnerable even doh e dey wear face mask. Dem don certify am negative 15 times"
According to di statement, true true di APC chieftain dey abroad but no be for france, e dey for London dey rest.
Tori been comot on Sunday say Tinubu catch covid-19, say dem don carri am go France for treatment since December.