Lagos lockdown: Why Federal goment wan shut down third mainland bridge from Friday January 29

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI
Authorities for Nigeria go shutdown di third mainland bridge completely for three days beginning from midnight Friday January 29 to Sunday January 31.
For statement Di federal controller of works Lagos Olukayode Popoola say di closure na sake of say dem wan cast concrete on top additional three expansion joints and dem no wan allow kind of vibration for di bridge.
"Di closure go last for 72 hours and wey dey sorry for di inconvenience dis go cause Lagos pipo" na so Mr Popoola tok.
Dis go mean say traffic go now dey heavy on alternative routes into di Lagos island particularly di Ikorodu road.
Thirdmainland bridge wey be one if di longest bridge been don dey undergo series of repair works since July 24, 2020.
Dem bin suppose open am for January but due to di EndSARS kasala dem delay di full reopening to February 15, 2021 according to di minister of transport Rotimi Amaechi.
FG Shut Third Mainland Bridge for 2020 Christmas weekend
Di Federal Controller of Works for Lagos State, Olukayode Popoola, confam say dem go totally shut down Third Mainland Bridge for Christmas weekend
For interview wit BBC News Pidgin, oga Popoola say "most likely" dem go close di bridge from midnight of Christmas day, Friday 25 December and reopen am for midnight of Sunday, 27th December, 2020.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di reason na to allow dem do di casting of di reconstruction work wey dey go on ontop di bridge on Saturday 26 December and by Sunday, dem go finish di work.
"We wan prevent vibration as we dey do di casting of di expansion on di Lagos Island bridge", he tok.

Dis no go be di first time wey di goment go close down di bridge sake of repair work. In recent time dem do am for 2018 and again for 2019 but e be like say dis one for 2020 go be major repair work.
But on 24 July dis year, Federal and Lagos State goment decide to close di bridge for 6 months rehabilitation work.
Im admit say di action of area boys ontop di bridge don disrupt di work of contractors because dem dey go reopen di area wey dem close but say di project dey progress well.
"On di Island-bound lane wia we dey work now, di contractor don ready to cast anoda three expansion joints dis weekend, but because of di festive period, we get a lot of vehicles on di road."
According to am, di work on di surface of di bridge dey over 70 percent complete.
Passengers dey advised to follow alternative route during dis period of total close down of di bridge.











