You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kidnapped Nigerian students: GSS Kankara Katsina schoolboys don arrive - See how die rescue from kidnappers happun
Kankara Government Science Secondary School boys wey gunmen bin kidnap a week ago don arrive Katsina goment house.
Govnor Aminu Masari dey meet with dem before medical pipo go begin to check dem one by one.
SSA social media to di govnor Muhammad Funtua tell BBC say medical pipo already dey on ground and immediately di govnor finish im tok with dem, dem go start dia work.
President Muhammadu Buhari go meet di boys later on Friday.
And video of dia arrival show say some of dem dey limp.
Exclusive: How Kankara students rescue from kidnappers happun
Zamfara state Govnor Bello Matawalle tell BBC say e siddon for negotiation table up to three times before di gunmen agree to release di 340 students wey dem kidnap.
Di govnor say na fulani gunmen kpake di boys and no be Boko Haram and na dem im goment negotiate with.
Na nigerian Army bring di boys out from bushes wey dey Tsafe town for Zamfara state around 6pm on Thursday after di students don spend six days with dia kidnappers.
End of Di one wey oda users dey read well well
"We siddon up to three times with dem (di gunmen) di first sitting fail, di second one too so na di third sitting finally succeed."
"During di negotiation, dis pipo (di kidnappers) explain di problems wey dem dey face and how dem wan make goment helep dem."
"Among dia complain na how some pipo dey kill dia cows and also how various vigilante units dey disturb dia life, so we promise dem say we go look into dat." Dis na wetin govnor tell BBC.
Di Zamfara govnor say dis negotiation route na one wey e go continue to take in order to dey solve criminality problem wey dey disturb dat area.
Regarding ransom payment, di former house of reps member turned govnor say dem no pay any kobo to di gunmen as na just negotiation happun.
"We no pay any kobo, we just siddon talk, dem tell us dia problems and we promise to look into am but money no exchange hands."
E say dem also discuss how to prevent dis kain bad event from ever happening again and conclude say wetin dey cause dis kain problem na lack of unity and co-operation.
Na Friday morning, di 340 students wey goment rescue go leave Gusau capital of Zamfara state to neighbouring Katsina state wey be dia base and wia di goment don plan special reception for dem wey include meeting President Muhammadu Buhari.