You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Sanwo-Olu: Coronavirus treatment of Babajide Sanwo-Olu of Lagos and wetin we know so far
Lagos State Govnor, Babajide Sanwo-Olu health dey improve and e go soon det free of coronavirus.
Dis na wetin di state Commissioner of Health, Akin Abayomi tok for statement wey e bin release on Tuesday, 15th December.
E tok say, for all di tests wey dem don do for im bodi, signs no dey say go get any wahala because of di Covid-19 infection.
Oga Sanwo-Olu bin test positive for di virus on Friday 12 December afta e bin come in contact with anoda confam case of di virus.
Tori be say, di govnor bin get mild symptoms wey include tiredness.
Oga Sanwo-Olu na di eighth govnor for Nigeria wey go catch di coronavirus wey so far don get 73,175 confam cases for di kontri.